BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Wetin we know about di heavy gunfire for Guinea-Bissau capital

Dem hear heavy gunfire on Friday morning

Fri, 1 Dec 2023 Source: BBC

Heavy gunfire dey reported for Guinea-Bissau capital on Friday morning, hours afta some National Guard sojas free one detained minister and one senior state official.

Members of di National Guard carry di officials before dem go hide dem for barracks, south of di capital.

Special forces later intervene afta attempts to negotiate fail, wey lead to exchange of gunfire.

Reports say dem later restore calm to di area.

Army don hold di leader of di group of sojas wey bin dey try free di two men. Dem tok say di “situation dey completely under control” AFP news agency quote one army tok-tok pesin.

Dem don detain Finance Minister Souleiman Seidi and António Monteiro, di secretary of state for di treasury, as investigations into alleged irregular withdrawal of $10m (£8m) of state funds dey go on.

One anti-corruption inquiry bin question dem on Thursday afternoon to explain di payments to 11 companies.

For one parliamentary session on Monday, leader of di kontri main opposition party bin allege say di owners of di companies dey close to leaders of di kontri governing coalition.

Oga Seidi don defend di payments, e say e dey legal.

On Thursday afta di questioning, dem arrest Oga Seidi and Oga Monteiro and detain dem so dem no go jeopardise di investigations, local media tok.

National Guard sojas later for evening invade di police cells, wey dey near Bandim market, "wit AK-47 weapons and bazookas" and dem comot di detained officials, di privately owned O Democrata news outlet report.

Di news outlet tok say di National Guard carry dem go unknown location.

President Umaro Sissoco Embalo currently dey out of di kontri, e dey attend di UN COP28 climate conference for Dubai.

On Friday morning, regional stabilisation forces wey di regional West African bloc Ecowas deploy dey patrol di streets, AFP news agency report.

Guinea-Bissau don suffer series of coups and attempted coups since dem gain independence from Portugal for 1974.

For February last year, di president tok say im survive one coup attempt afta e dey under heavy gunfire for five hours - for one accident wey lead to di death of 11 pipo.

Witout providing details, e tok say di attack dey linked to drug trafficking for di kontri.

Some pipo, however, doubt di official version of di events, as questions wey dey ground include who really dey behind di attempt, how many pipo dey involved and who dey in command.

No full answers dey to dis questions.

Source: BBC