BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Wetin we know about di murder of Uniport student Justina 'Tiffany' Otuene

94277193 Tiffany Otuene realn name na Justina Otuene Nkang

Thu, 26 Oct 2023 Source: BBC

Di horrifying death of one undergraduate student Justina Otuene Nkang wey pipo sabi as 'Tiffany’ dey attract serious vex.

Tiffany na 300 level student of di University of Port Harcourt for Rivers state, South south Nigeria.

Tori be say na di estate security for one neighbourhood for NTA Road Mgbuoba, Port Harcourt discover di body of one young girl.

Dem catch one man wey dem say na her boyfriend wen e dey try move di deadi body comot – nfere dem alert police wey arrest a.

Videos wey dey circulate on social media show how di said boyfriend in handcuffs lead police officers go im house.

For di house wey be like studio apartment – di man carry di investigators enta one room wia wheelbarrow dey inside.

Wetin dey on top di wheelbarrow full sack wey dem wrap well-well wit blood stains.

For di video, pesin fit also see plenty stream of blood for ground.

Pipo still dey wan sabi di true identity of di man wey commit di crime.

Many social media users wey don see di tori dey claim say di suspect slaughter Tiffany – say e cut different parts of her body comot.

In di meantime, di Rivers state police command don schedule tok-tok wit tori pipo to reveal wetin happun

Source: BBC