Cameroonians dey wait for di result of di presidential election wey hold on Sunday, 12 October
Cameroonians dey wait for di result of di presidential election wey hold on Sunday, 12 October.
According to di Cameroon electoral code, di Constitutional Council wey go announce di result get 15 days to declare di official results from di day di polls close.
Polls bin close on Sunday for di West African nation and vote counting dey on.
Cameroon Interior Minister Paul Atanga Nji tok say di voting exercise dey "hitch-free" across di kontri.
Dis dey come despite reports of clashes between supporters of Issa Tchiroma Bakary, wey be leading opposition candidate and former President Biya paddy for Garoua – im hometown and stronghold.
Di supporters bin clash wit security forces wey fire teargas to stop dem make dem no gada around Tchiroma house.
However, despite di tension for di north, Interior Minister Paul Atanga Nji insist say di election dey free and fair wit no major incidents for all ten di regions of di kontri.
Among Biya challengers for di race na two of im former northern allies, Issa Tchiroma Bakary and Bello Bouba Maigari. Dem don criticise di president style of governance and dem promise to bring change.
Several voters tok say dem hope say di next president go bring change to di kontri wey get many problems, wey include poor social services.
Analysts say Biya wey no ever lost an election throughout im 43-year rule na di favourite to win di election, as di main opposition leader Maurice Kamto bin dey excluded from di race.
Na afta di ruling on di petitions, di council fit come announce di results and declare di winner of di election.
If afta di 15 days, di council no declare any winner, maybe sake of say di election dey cancelled, di incumbent president go remain for office until dem conduct new election.
Di new election go hold within no less dan 20 days and no more dan 40 days afta di date dem cancel di initial election.
Dia role na to rule on all petitions wey any candidate or any political party wey take part for di election file, and to rule on any petition wey anybody wey dey serve as a representative of di administration, wey dey request for di total or partial cancellation of election operations.
According to di electoral code, all petitions wey anybody file must reach di Constitutional Council within and not more dan 72 (seventy-two) hours afta di polls close.