Menu

Where be Saint Kitts and Nevis, di first non-Ecowas country wey Nigeria grant free visa entry

Jkl.png From 1 September 2025, citizens of Saint Kitts and Nevis go fit enta Nigeria without visa

Mon, 29 Sep 2025 Source: BBC

From 1 September 2025, citizens of Saint Kitts and Nevis go fit enta Nigeria without visa.

Dis go make di Caribbean nation di first country outside Africa to enjoy visa-free entry to Nigeria, di govment of Saint Kitts and Nevis tok for statement on top dia website.

Saint Kitts Prime Tarrence Drew for di statement welcome di move and say na testament to di deepening friendship between di Caribbean and Africa. E say e don tey wey Saint Kitts and Nevis don extend visa-free access to Nigerian nationals, and im dey happy say Nigeria don reciprocate wit di same spirit of unity and mutual respect.

"Dis na symbolic and practical step in reconnecting our pipo. St. Kitts and Nevis for long don grant visa waivers to Nigerian citizens, and we dey pleased say Nigeria don return di favour inside spirit of unity and mutual respect," e tok for statement.

E add say dis agreement reflect di shared vision of St. Kitts and Nevis and Nigeria to remove barriers and strengthen relations across di Atlantic gateway.

E dey important to note say Nigerians fit also travel go St. Kitts & Nevis visa-free, within some requirements.

Di waiver, wey cover ordinary, official, and diplomatic passports dey expected to expand trade, investment, and cultural ties between di two countries.

Nigeria Television Authority (NTA), Nigeria national television network report say di agreement dey come afta one Afri-Caribbean Investment Summit (AACIS '25) wey Aquarian Consult Limited (ACL) organise earlier dis year for Abuja, di country capital.

Managing Director of ACL, Aisha Maina, bin describe di agreement as di outcome of deliberate engagement. "Dis visa waiver dey more dan diplomacy; e dey about opening doors for trade, investment, and cultural exchange," she tok.

Why Nigeria grant St. Kitts and Nevile visa free entry

Until now, Nigeria visa-free policy apply mostly to citizens of ECOWAS states, wit Cameroon and Chad as di only non-ECOWAS African kontris wey dey enjoy such access.

Global Citizen Consultants, wey describe demselves as di Original Authorized Agent for di Governments of di Caribbean bin give more informate on di free-visa-entry.

According to one statement on dia website, dem say dis development bin start afta one diplomatic visit between di govments of St. Kitts and Nevis and Nigeria.

Earlier dis year, di Prime Minister of St. Kitts, Theresa Drew bin make one working visit to Nigeria earlier dis year to sign historic memoranda of understanding wit di Special Economic Zone Management Company, wey also dey known as di Green Economic Zone (GEZ).

Di memorandum wey St. Kitts and Nevis and Nigeria bin sign bin aim to establish advanced agricultural warehouses and logistics centers within St. Kitts and Nevis.

"Dis cooperation na important part of di African-Caribbean Atlantic Cooperation (ACAC), wey go focus on strengthening trade relations between di Caribbean and Africa," di statement tok.

During im meeting wit President Tinubu, Oga Drew emphasize di importance of strengthening economic ties between di two regions. E say, "Our goal no be for tins to go one way, so meetings go dey between di Minister of Agriculture and producers here for St. Kitts and Nevis to prepare our products wey we intend to send to West Africa."

Dis agreement go pave di way for di establishment of one special trade corridor between Africa and di Caribbean, wey go begin wit di export of agricultural products.

E encourage local producers for Saint Kitts to increase production and ensure compliance wit international standards in preparation for export to Africa.

E note say small portion of di African market go get ogbonge impact on di local economy and go support virtually all industries in Saint Kitts and Nevis.

For im part, di Nigeria leader express im support for dis initiative and agreement.

Wetin to know about Saint Kitts and Nevis

Saint Kitts and Nevis bin dey among di first islands for di Caribbean wey Europeans colonise.

Na English and French colonialist settle for St Kitts for di 1620's, wey battle three-year war of extermination against di native Caribs. Dem bin establish one sugar plantations, wia Africans wey dem transport as slaves go di islands dey work.

Di islands of St Kitts – wey also dey known as St Christopher - and Nevis don dey for uneasy federation since independence from Britain for 1983, as some politicians for Nevis dey of di opinion say di federal govments for St Kitts – wey be home to majority of di population – don ignore di needs of Nevisians.

But one referendum on secession wey hold for Nevis for 1998 bin fail to gain di two-thirds majority dem need to break away.

Under di constitution, Nevis get considerable autonomy and dem get island assembly, one premier, plus one deputy governor-general.

Tourism, offshore finance and service industries be important sources of income for di country.

Facts about St Kitts and Nevis

.Capital Basseterre

.Area: 261 sq km

.Population: 47,600

.Languages: English, plus St Kitts Creole

.Life expectancy: 72 years (men) 77 years (women)

.

Dia Head of State na King Charles III, and e dey represented by one governor-general. Di Prime Minister na Terrance Drew.

Dem elect Oga Drew as prime minister afta im St Kitts-Nevis Labour Party (SKNLP) win di August 2022 general election.

Dis agreement according to St. Kitts go bridge di gap between West Africa and di Caribbean, and e go provide plenti economic opportunities, provide access to a wider market, plus economic resilience, particularly through di export of agricultural products.

For long-term benefits, dis agreement go open new horizons between di Caribbean and Africa, expand cooperation beyond just agriculture. E go also make Saint Kitt and Nevis passport holders key players for global trade, pave way for prosperity both domestically and internationally.



Source: BBC