BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Who be Christian Malanga wey lead di failed coup for DR Congo

Screenshot 2024 05 20 113511.png Marcel Malanga

Mon, 20 May 2024 Source: BBC

Christian Malanga na 41 year-old-man wey dem born for Kinshasa on 2 February 1983.

Im papa na Joseph Itedjo Malanga from di Mangai Village and im mama na Christine Kapayi for Kinshasa.

At age five, e lose im mama, and im papa later remarry Chantal Kibonge Malanga. Christian Malanga na di oldest of six pikin of her late father.

Malanga bin live for Swaziland at di age of 15-year-old as political refugees in 1993 and later move to Salt Lake City, Utah, in 1998 as refugee.

E later return to Congo for 2007 as military captain afta e co-founder one non-profit called Africa Helpline Society for 2006

Malanga run as parliament in 2011 but dem arrest am two days bifor di poll. For 2017, e create goment for exile in Brussels, name di New Zaire, wey im wan restore sovereignty to di Congolese people.

E proclaim im sef as president of di United Congolese Party (UPC), as he claim to dey fight for prosperous and safe new DRC.

Dis na national political party wey e form afta im experience during di 2011 parliamentary elections.

Malanga dey successful for both business and politics until e die on Sunday, 19 May 2024 wen e bin lead failed coup against di goment of Felix Tshisekedi for Congo for di Palais de la Nation.

Christian Malanga na former Congolese military officer wey dey live for di United States wit im family.

Malanga campaign on religious freedom and dem appoint am as dii first ambassador of di International Roundtable on Religious Freedom for 2013.

Christian Malanga dey popular for im hostile videos against di regime of president Félix Tshisekedi from di USA, wia im bin dey base bifor dis attack on di president.

Christian Malanga na di papa of 21 year-old Marcel Malanga and seven oda pikin wey im born wit Lucile Malanga

Marcel Malanga also wey follow im papa go for di failed coup on Sunday.

E bon Marcel for 2003 and e don spend all in life for Utah, as e dey active ontop im social media as e bin dey post fotos of im lifestyle.

Afta Christian Malanga move to USA, e attend Highland High School. As e graduate from High School, e start small businesses for Africa.

Christian Malanga and im family non-profit organization adopt ova 20 children wey dem support dia education for Africa.

Im political journey start wen e join di military for Congo e lead troops against di Mai-Mai rebel group. That is when he witnessed a vast effects of government corruption.

Source: BBC