Menu

Who be Natasha Osawaru wey Tuface dey tok about?

Natasha 2Face.png Natasha Osawaru (Left) and TuFace Idibia

Wed, 12 Feb 2025 Source: BBC

Di controversy around Nigeria music star, Innocent Idibia wey pipo dey call 'TuFace Idibia' relationship don kontinu to ginger reactions from fans and critics.

Video of wia Tuface siddon for di gallery of di Edo state house of assembly circulate on Monday.

Di Nigerian singer no tok anytin for di video wey make pipo tink say e get connection wit one of di Lawmakers Natasha Osawaru.

All dis dey happun weeks afta Tuface announce im separation from Anie Macaulay Idibia, im wife of ova 10 years.

E make di announcement for inside one post e share on im Instagram account. E don since delete di video.

"Well dis tin wey I wan tok dey short but also long. I and Annie Macaulay don separate for a while now. And currently filed divorce," Tuface tok.

For di post, di 49-year-old singer promise to release a statement soon to share im side of di tori.

E add say while im personal life dey private, e feel say e dey necessary to provide clarity out of love for im supporters.

But aft aim video for Edo assembly complex go viral, Tuface release anoda three minutes video to addresss wetin e say n aim relationship wit di lawmaker, Natasha Osawaru.

For di video wey e caption "To Whom It May kwansighn. I don yarn my truth. Feel free to kontinu to allege, We go all dey alright," e tok in defence of di politician.

Who be Natasha Osawaru

Her name na Natasha Irobosa Osawaru but pipo dey call her Honourable Natasha.

She be politician and a member of di Edo state house of Assembly. She be member of Peoples Democratic Party (PDP).

Details from di Independent National Electoral Commission (Inec) say Natasha come from Egor Local goment area of Edo state, Southern Nigeria.

Dem born am on November 14, 1994. She go be 31-years-old by 2025.

Currently she be di Deputy Majority Leader of di Edo State House of Assembly, representing Egor Constituency.

Natasha get law degree from Igbinedion University and later get Master's degree in Film Production from Full Sail University United States.

Bifor she join politics, she bin dey advocate for youth and women development.

She also focus her energy on advocating for policies wey go promote economic growth, social welfare, and infrastructural development for Edo state and Nigeria.

Who be Innocent Idibia?

Dem born Nigeria music star Innocent Idibia aka 2Baba for Jos, Plateau state, north-central Nigeria. E hail from Benue state.

Popularly known as 2Baba, na Nigerian singer, song-writers and record producer. E dey regarded as one of di most influential and greatest Afrobeat artists of all time sake of im contribution to di Nigerian music industry.

Im professional music career wit Plantashun Boiz (one group wey no dey again). Dem be three wey form di group, himself and two odas - Blackface and Faze.

Plantashun Boiz release two successful albums: Body and Soul (2000) and Sold Out (2003) under Nelson Brown label, Dove Records, bifor dem break-up for 2004.

Afta di disbandment of Plantashun Boyz ifor 2004, all band members bin go solo for dia musical careers. 2Baba release im debut solo album Face 2 Face for 2004 wey make am tanda gidigba as solo artist.

E don release several albums afta dis one and win plenty awards wey include; MTV Europe Music Award and World Music Award, The Headies Award for Song of di Year, Channel O Music Video Awards, and one BET Award.

Source: BBC