Lieutenant Colonel Abubakar-Surajo Imam
Di school wey dey train sojas for Nigeria, di Nigeria Defence Academy (NDA) award Lieutenant Colonel Abubakar-Surajo Imam as di first officer wey dem make professor.
Lieutenant Colonel Abubakar-Surajo Imam wey dey among di serving personnel of di Nigerian Army, na Professor of Mechatronics Engineering.
Di Registrar of di Academy, Brigadier General A.M Tukur, for inside statement say di promotion of Lieutenant Colonel Imam wey also be di Head of di Department of Mechatronics Engineering bin dey ratified during di NDA Council Meeting for September and take effect from 1 October, 2022.
Di statement explain say di decision of di Academy Council na reflection of di confidence and recognition of di contributions of Imam to di Department of Mechatronics Engineering of di NDA.
Im add say di new professor don set exemplary services and uphold di standards of excellence wey dey expected for im field.
Im get Bachelor’s degree for Mechanical Engineering from Bayero University, Kano State.
E also get Master’s degree for Mechatronics from Newcastle University, United Kingdom.
E get PhD for Mechatronics and Robotics from di same university.
Di new professor na Examiner and Member Central Selection Committee for Masters and PhD candidates wey Petroleum Technology Development Fund dey sponsor.
For im military career, Imam later convert to Regular Commission wia e serve for plenti units like 1 Base Workshop, Technical Group EME, HQ Nigerian Army Electrical and Mechanical Engineering Corps and Defence Industries Corporation of Nigeria (DICON).