BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Who be di Nigerian actor wey escape death for Cameroon?

55139776 Sylvester Madu bin survive one attack from armed men for Cameroon

Mon, 27 Nov 2023 Source: BBC

Nollywood actor, Sylvester Madu bin survive one attack from armed men for North West region of Cameroon wey kill at least six pipo on Saturday.

Di attack happun around 10:00pm for one popular bar for Bamenda wia di actor bin go to act for feem and campaign against drug addiction.

Sylvester and oda crew members bin dey di bar wen di attackers start to shoot pipo wey enta di bar to see di feem star.

Di mayor of di area, Fongu Cletus tell BBC say di star bin no dey attacked and security forces bin carry am go safe location.

E no clear why di gumen, wey be suspected separatists come di bar but di mayor bin suggest say e fit be to kidnap di star.

Mayor Fongu Cletus bin reveal say, "as dem bin dey shoot, three pipo die dia and three more die for hospital", as im tok say odas bin get injury and bin collect treatment.

Killing and kidnapping for ransom don turn normal tin for di kasla wey dey happun inside Cameroon Anglophone region, dat na why wetin happun on Saturday attack na just one of di tins to wey torchlight wetin don dey happun for di last six years.

Bamenda dey di center of di violent kasala between Anglophone separatists and state forces.

Di kasala don kill at least 6000 pipo. Hundreds of thousands more don run comot dia house because of am, according to di International Crisis Group.

Who be Sylvester Madu?

Sylvester Madu, wey dem dey popularly called Shina Rambo dey popular for di armed robber feem dem wey im dey normally act.

E cause controversy for Bamenda afta im land for di first day of feeming, wen e say Bamenda na ghetto.

E tok say, "see di kain ghetto, wey dem carry me enta, omo una get correct ghetto for hia ooo".

Many Cameroonians bin no gbadun am and go social media to vent on top di mata.

Howeva, im neva tok on top di attack wey happun on Sunday.

Sylvester Madu be actor, director, screenwriter, and producer.

According to IMDb, dem born am for Anambra state for January 10, 1975.

E dey popular for di movie Bullet of Justice and The Casket.

So far, im don star in ova 50 movies and direct five and write for four feems.

E don act with both Nigerian and Ghanaian actors like Ramsey Nouah, Bob Manuel, Patience Ozokwo, Segun Arinze, and Yvonne Nelson.

Earlier dis year for June, Sylvester Madu bin trend on top video wey comot say im dey sell okrika.

But im tok say wetin e dey sell be market wey im import come from di US, dis na inside interview wey im do wit local tori pipo Vanguard.

Source: BBC