Picture wey show di 48 pipo wey Hamas bin still hold hostage before di release
Israeli military say all 20 living hostages for Gaza now don dey handed over.
Until Monday, 48 hostages bin still dey captive for Gaza, 20 of dem dey believed to be alive.
All but one dey among di 251 pipo dem kidnap during di Palestinian group attack on southern Israel on 7 October 2023, for wia dem kill about 1,200 oda pipo.
Israel bin respond by launching one military campaign for Gaza, for wia more dan 67,000 pipo don die, according to di health ministry wey Hamas dey run..
List of 20 living hostages for Gaza wey dey released
Eitan Mor, 25, bin dey work as security guard for di Nova music festival. Im papa Mor say e bin saved dozens of pipo before Hamas gunmen kidnap am.
Alon Ohel, 24, get Israeli, German and Serbian citizenship. Hamas footage show as dem dey take am away as hostage from di Nova festival. Dem no see Alon until anoda video for August 2025, wia dem show as dem dey drive am around Gaza City wit Guy Gilboa-Dalal. Last month, Alon family approve one publication of a still from one new video wey show e don blind for one eye.
Gali and Ziv Berman, dem abduct 28-year-old twin brodas, from Kibbutz Kfar Aza wit neighbour, Emily Damari. Dem hold Ziv wit Emily for 40 days before dem separate dem. Dem release am for January 2025 during di last ceasefire. Gali and Ziv family say dem don dey informed by oda hostages dem release in early 2025 say dem still dey alive.
Guy Gilboa-Dalal, 24, attend di festival wit im broda, Gal, wey say di last time dem see each oda na just before Hamas launch im first rockets into Israel at di beginning of di attack.
Matan Angrest, na 22-year-old Israel Defense Forces (IDF) soldier, e bi dey for di tank wey bin dey attacked near di Gaza perimeter fence on 7 October. Earlier dis year, im family say hostages dem release for Gaza say e dye suffer from chronic asthma, untreated burns and infections.
Omri Miran, 48, bin dey abducted from im home for Nahal Oz. Im wife, Lishay, say she last see as dem dey drive am go for im own car.
Ariel Cunio, 28, wey dem abduct for di attack on Kibbutz Nir Oz on 7 October.
David Cunio, 35, anoda of Ariel brodas, wey dem also also kidnap from Nir Oz.
Matan Angrest, one 22-year-old Israel Defense Forces (IDF) soldier, we bin dey di tank wey dem attack near di Gaza perimeter fence on 7 October.
Matan Zangauker, 25, dem take am wit im partner Ilana Gritzewsky from Nir Oz.
Eitan Horn, 38, wey be Israeli-Argentine dual national, bin dey kidnapped along wit im elder brother Yair from Nir Oz.
Nimrod Cohen, 21, bin dey serve as IDF soldier wen im tank bin dey attacked by Hamas at Nahal Oz.
Yosef-Chaim Ohana, 25, bin dey di festival wit im friend, wey say dem bin stay back to help pipo wey escape di gunfire before dem run themselves.
Avinatan Or, 32, bin dey kidnapped for di festival along wit im girlfriend, Noa Argamani, but dem separated dem immediately. Dem rescue Noa and three oda hostages for one Israeli military operation for central Gaza for June 2024.
Maxim Herkin, 37, na Israel-Russian dual national wey dem invite to di festival at di last moment. Im two friends dey among di 378 pipo wey die for di attack.
Bar Kupershtein, 23, bin dey work for di festival and stay behind during di attack to help treat casualties. E bin tell im grandmother say e go head home as soon as dem finish.
Segev Kalfon, 27, bin dey run from di festival wit im friend wen Hamas gunmen kidnap am.
Evyatar David, 24, bin dey di festival and on di morning of di attacks, e text di family to say "dem dey bombard party". Im family say dem later receive one text from one unknown number, wey contain video footage of Evyatar wey dem handcuff on di floor of a dark room. For August 2025, Hamas publish one video of emaciated and weak Evyatar for tunnel. Di spark serious reactions for Israel and deep concern among im family. "E be human skeleton. Dem dey starve am to di point wia e fit die at any moment," im broda Ilay bin tok.
Rom Braslabski, 21, bin dey work on security for di festival. According to one account published by Hostages and Missing Families Forum, e bin dey try to rescue one injured person for di attack wen e bin hook.
Hostages wey dia conditions no dey knownTamir Nimrodi, 20, be education officer for di IDF for di Erez Crossing on 7 October. Di last time im mother, Herut, see am na for one video of im abduction wey dem post on social media dat day.
Bipin Joshi, 24, na Nepalese agriculture student, wey dem kidnap from Kibbutz Alumim. Footage from 7 October 2023 show am dey waka inside al-Shifa hospital for Gaza City.
Hostages wey dey confirmed deadTamir Adar, 38, na a member of Nir Oz community security squad wey dem kill as e dey fight Hamas gunmen during di 7 October attack, im kibbutz announce for January 2024. Hamas dey hold di body of di farmer and father-of-two for Gaza.
Sonthaya Akrasri, 30, na Thai agricultural worker wey die for di attack on Kibbutz Be'eri, Thailand foreign ministry tok for May 2024, dem citie available evidence. Hamas also hold im body for Gaza.
Muhammad al-Atarash, 39, be sergeant-major for di IDF and bin serve as tracker. For June 2024, IDF confirm say dem kill di father-of-13 from di Bedouin village of Sawa while e dey fight Hamas gunmen near Nahal Oz on 7 October and say im body dey Gaza.
Sahar Baruch, 24, bin dey kidnapped from Be'eri. For January 2024, IDF announce say dem kill am during one rescue attempt by Israeli forces for Gaza. E no clear whether na Hamas or Israeli gunfire kill am.
Uriel Baruch, 35, bin dey abducted from di Nova festival. For March 2024, di father-of-two im family say IDF tell dem say dem don kill am in captivity for Gaza.
Inbar Hayman, 27, bin dey kidnapped during di attack on di Nova festival and Hamas kill am in captivity, her family tok. She be di last female hostage wey dem bin dey hold.
Itay Chen, 19, be Israeli-American wey bin dey serve as a soldier for di IDF on 7 October. IDF say dem kill am during Hamas attack on Nahal Oz base.
Amiram Cooper, 85, bin dey abducted from Nir Oz. IDF say dem kill am for June 2024 along with three oda hostages - Nadav Popplewell, Chaim Peri and Yoram Metzger - months earlier for Khan Younis, southern Gaza.
Oz Daniel, 19, na sergeant for IDF 7th Armoured Brigade and dem kill am during one battle wit Hamas gunmen near Gaza perimeter fence on 7 October.
Ronen Engel, 54, bin dey kidnapped from Nir Oz on 7 October along wit im wife, Karina Engel-Bart, and dia daughters, Mika and Yuval. Karina, Mika and Yuval bin dey released during di ceasefire in November 2023. Di following month, IDF confirm say dem kill Ronen for captivity.
Meny Godard, 73, bin dey killed during di attack on Be'eri wit im wife, Ayelet, and dem carri im body go Gaza as hostage, im family tok for February 2024.
Ran Gvili, 24, na sergeant for Israel Police wey dem kill while e dey fight Hamas-led gunmen for Kibbutz Alumim on 7 October.
Tal Haimi, 41, na part of Kibbutz Nir Yitzhak rapid response team and dem kill am during di attack dia on 7 October.
Asaf Hamami, 41, na colonel for di IDF and commander of di Gaza Division Southern Brigade. Dem kill am near Kibbutz Nirim on 7 October.
Guy Illouz, 26, bin dey shot twice during di attack on di Nova festival and e die from di wounds after dme take am hostage, im family tok.
Eitan Levi, 53, na taxi driver wey Hamas gunmen kill for one road close to di Gaza perimeter on 7 October. Dem carri im body go Gaza, wia video show Palestinians dey beat and kick am.
Eliyahu Margalit, 75, bin dey killed by Hamas fighters for Nir Oz on 7 October, IDF confirm for December 2023.
Joshua Mollel, 21, na Tanzanian student wey bin dey do agricultural internship for Kibbutz Nahal Oz wen dem attack am on 7 October. Tanzanian govment confirm for December 2023 say dem kill am dat day and im body bin dey wit Hamas.
Omer Neutra, 21, na Israeli-American and grandson of Holocaust survivors, wey bin dey serve as IDF tank commander near Gaza wen Hamas attack on 7 October.
Daniel Peretz, 22, na captain for di IDF 7th Armoured Brigade. Originally from South Africa, dem kill am for di attack on im tank near Nahal Oz on 7 October and dem carrri body go Gaza, IDF tok.
Dror Or, 48, and im wife, Yonat, bin dey killed for di attack on Be'eri, di kibbutz dey confirmed in February 2024. Two of im three children, Noam and Alma, bin dey taken hostage and dem release dem as part of di November 2023 ceasefire deal. Dror body dey for Gaza.
Suthisak Rintalak, 43, na Thai agricultural worker wey dem kill for di attack on Kibbutz Be'eri, Thailand foreign ministry tok for May 2024, citing di available evidence.
Lior Rudaeff, 61, bin dey killed while e dey attempt to defend Nir Yitzhak from attack on 7 October, di kibbutz tok.
Yossi Sharabi, 53, bin dey kidnapped from Be'eri along wit im brother, Eli. For January 2024, di kibbutz announce say di father-of-three bin dey killed in captivity for Gaza.
Arie Zalmanowicz, 85, bin dey abducted from Nir Oz on 7 October. For November 2023, Hamas release video wey show as e say e no well. Di following month im kibbutz say e die for captivity.
Hadar Goldin, 23, na lieutenant for di IDF Givati Brigade wey dem kill in combat for Gaza in 2014. Hamas don hold im body hostage since den.