BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Who be di policeman wey shoot magistrate inside open court

Screenshot 2024 06 13 154411.png One senior Kenyan police officer don die afta dem shoot am inside court.

Thu, 13 Jun 2024 Source: BBC

One senior Kenyan police officer don die afta dem shoot am inside court.

Dem shoot di officer afta im open fire on one magistrate inside di court for di capital, Nairobi.

Di chief inspector open fire on Makadara Principal Magistrate Monica Kivuti just afta she deliver her ruling one one case wey reportedly involve im wife.

Tori be say di decision of di court wey cancel her bail afta she bin don run vex di officer.

Di officer wey im name na Samson Kipchirchir Kipruto, wey dey incharge of one police station in Londiani in western Kenya, den pull out im gun and shoot di magistrate – wey wound her.

Oda officers wey bin dey court give am back immediately, one of dem shoot di policeman wey commit and kill am.

Three oda officers wunjure in di process, police report tok.

Di magistrate and di officers wey wunjure dey collect treatment for hospital.

Di judiciary tok say di magistrate bin "cancel di bond for one accused pesin wey bin jump bond and no give better explanation why she jump bond".

"Immediately wey dis decision dey pronounced, one pesin shoot di magistrate and wunjure her for hip,” dem tok for statement.

Dem confam di tori say "di shooter na police officer wey dey married to di suspect".

Di national police service tok say dem no sabi di reason why di officer dey di court.

Dem go kontinu to chook eye for di matter to fit sabi wetin lead to di shooting, di statement add.

Di incident inside courtroom na shock to Kenyans.

Police for Kenya many time don chop accuse say dem dey get hand for extra-judicial killings but dat kind incident neva dey reported inside court.

Di judiciary don tok say dem go improve security and don assure judicial staff and oda court users of dia safety and security.

"As di judiciary family, we wish our colleague quick recovery. We also send our sorry to di family of di officer wey lost im life for dis unfortunate incident,” chief registrar of di judiciary Winfridah Mokaya tok.

Source: BBC