Police for Florida arrest 26-year-old, Kodak Black wey be America rapper afta dem see cocaine for im vehicle, three years afta former president Donald Trump pardon im sentence for 2020.
Di 26-year-old rapper, wey im real name be Bill Kapri, appear for court on Thursday sake of cocaine charges, wen Florida police authorities charge am to court.
On Thursday, di Plantation, Florida court, charge di rapper for tampering wit evidence and improper parking of vehicle.
Di rapper start im music career for 2014 afta im release im single “No Flockin”, im later release im first album for 2017, wey reach di top 10 of US Billboard Hot 100.
Black gain popularity for US afta Drake dance to im song Skrt ontop im Instagram page.
Di rapper don sell more dan 30 million singles and e don collaborate wit artists like Kendrick Lamar, Travis Scott and Jason Derulo.
For 2019, dem arrest di rapper wen im bin dey age 22-year-old as im falsify information on goment form to buy gun from Miami shop.
Dem sentence di rapper to three years and 10 months for federal prison afta dem find am guilty of weapon charges.
Afta e don spend half of im jail sentence, Donald Trump grant pardon to di rapper among di 140 pipo wey dey di list for 2021.
Dis no be di first time wey dem go arrest di rapper base on accusation of drugs possession. For 2022 dem arrest am for Fort Lauderdale wit marijuana, nylon bag and moni.
Afta im refuse to show for drug test, Black receive order say make im spend 30 days for rehabilitation centre.
Kodak also still face charges of criminal sexual assault for Florence, South Carolina for 2021, di rapper agree to deal, wey come let di court sentence am to 18 months of probation.
Dem arrest di rapper for 2019 wen im lie for document to buy gun for US.
For June 2020, Kodak Black serve federal sentence for high-security prison but dem come transfer am go penitentiary prison for US but di former US president sign im release letter.