BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Who go be di Ballon d’Or 2023 winner ?

Lionel Messi and Aitana Bonmati na di favourites to win di men and women awards

Mon, 30 Oct 2023 Source: BBC

Inter Miami player Lionel Messi na di favourite to win dis year Ballon d’Or’ award according to sports sabi pipo.

Dem dey tip Messi to pick up di award for a record eighth time afta im help im kontri win di World Cup for Qatar for December.

Even though many pipo dey also expect Manchester City Erling Haaland and PSG Kylian Mbappe to do well for di voting process.

For di women, na Barcelona player Aitana Bonmati be di favourite to win.

Di Ballon d'Or na ogbonge football award. Some of di greatest players for history don win di award wey French magazine 'France Football', dey organize.

Dis award na annual event wey start since 1956, except for 2020, wey dem pause am sake of COVID-19 pandemic.

Last season, na former Real Madrid captain Karim Benzema win di Ballon d’Or while Barcelona Alexia Putellas win di women award for a second straight year.

Dis na wetin you need to know ahead of di award ceremony:

Wen be di Ballon d’Or award?

Di 67th annual Ballon d’Or ceremony go take place on Monday 30 October 2023. E dey expected to start by 7:00pm West African Time for di Theatre du Chatelet for Paris.

How to watch di Ballon d’Or?

Di ceremony go dey live on DSTV sport channel, Supersport for Nigeria and Ghana.

Na Chelsea legend Didier Drogba go host di ceremony.

Who be di Ballon d’Or nominees?

Men Ballon d'Or 2023 nominees

Josko Gvardiol (Manchester City)

Andre Onana (Manchester United)

Karim Benzema (Al Ittihad)

Jamal Musiala (Bayern Munich)

Mohamed Salah (Liverpool)

Jude Bellingham (Real Madrid)

Bukayo Saka (Arsenal)

Randal Kolo Muani (Paris Saint Germain)

Kevin de Bruyne (Manchester City)

Bernardo Silva (Manchester City)

Khvicha Kvaratskhelia (Napoli)

Emiliano Martinez (Aston Villa)

Ruben Dias (Manchester City)

Nicola Barella (Inter Milan)

Erling Haaland (Manchester City)

Yassine Bounou (Al Hilal)

Martin Odegaard (Arsenal)

Julian Alvarez (Manchester City)

Ilkay Gundogan (Barcelona)

Vinicius Jr (Real Madrid)

Robert Lewandowski (Barcelona)

Antoine Griezmann (Atletico Madrid)

Lautaro Martinez (Inter MIlan)

Lionel Messi (Inter Miami)

Rodri (Barcelona)

Kylian Mbappe (Paris Saint German)

Kim Min-Jae (Bayern Munich)

Victor Osimhen (Napoli)

Luka Modric (Real Madrid)

Harry Kane (Bayern Munich)

Women Ballon d'Or 2023 nominees

Alba Redondo (Levante Union Deportiva)

Kadidiatou Diani (Lyon)

Rachel Daly (Aston Villa)

Linda Caicedo (Real Madrid)

Fridolina Rolfo (Barcelona)

Olga Carmona (Real Madrid)

Amanda Ilestedt (Arsenal)

Hayley Raso (Real Madrid)

Georgia Stanway (Bayern Munich)

Sophia Smith (Portland Thorns)

Hinata Miyazawa (Manchester United)

Salma Paralluelo (Barcelona)

Lena Oberdorf (Wolfsburg)

Millie Bright (Chelsea)

Daphne van Domselaar (Aston Villa)

Sam Kerr (Chelsea)

Patricia Guijarro (Barcelona)

Ewa Pajor (Wolfsburg)

Debinha (Kansas City)

Guro Reiten (Chelsea)

Yui Hasegawa (Manchester City)

Aitana Bonmati (Barcelona)

Jill Roord (Manchester City)

Alexandria Popp (Wolfsburg)

Katie McCabe (Arsenal)

Mary Earps (Manchester United)

Wendie Renard (Lyon)

Mapi Leon (Barcelona)

Asisat Oshoala (Barcelona)

Khadija Shaw (Manchester City)

Kopa Trophy 2023 nominees

Rasmus Hojlund (Manchester United)

Jamal Musiala (Bayern Munich)

Alejandro Balde (Barcelona)

Pedri (Barcelona)

Jude Bellingham (Real Madrid)

Antonio Silva (Benfica)

Eduardo Camavinga (Real Madrid)

Xavi Simons (RB Leipzig)

Gavi (Barcelona)

Elye Wahi (Lens)

Yachine Trophy 2023 nominees

Emiliano Martinez (Aston Villa)

Mike Maignan (AC Milan)

Thibaut Courtois (Real Madrid)

Aaron Ramsdale (Arsenal)

Yasssine Bounou (Al Hilal)

Andre Onana (Manchester United)

Dominik Livakovic (Fenerbahce)

Marc-Andre Ter Stegen (Barcelona)

Ederson (Manchester City)

Brice Samba (Lens)

Source: BBC