BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Why Abike Dabiri-Erewa comment cause gbas-gbos on social media

40644628 Chairman NIDCOM, Abike Dabiri-Erewa

Wed, 19 Oct 2022 Source: BBC

Plenti reactions don follow one response wey di Chairman, Nigerians in Diaspora Commission (NIDCOM) Chairman, Abike-Dabiri-Erewa sama one Twitter user afta e challenge how she take dey handle diaspora matters. Di gbasgbos start on Monday wen Abike Dabiri enta Twitter to give update one viral video wey tok say dem dey attack Nigerian students for one University campus near Delhi, India. She tweet say Nigeria goment say Indian Authorities don agree for one written commitment to protect Nigerian students for India. As response to dis tweet, one Twitter user say make she go Indonesia go see how dem dey treat Nigerians for there and also use style insult her, call her "mumu". Abike for her response call am ‘Ode’ (Yoruba word for 'foolish pesin') say na drugs and cultism dem dey go do for Indonesia. "If di Indonesian goment later sentence dem to death, dem go begin beg Nigerian goment to rescue dem. " Dis tok generate reactions as some pipo hail di Nidcom oga for her response, odas say as public official she for no tok like dat.

Ode! You go to Indonesia, carry drugs, do cultism and come begging to be rescued from death sentence . Thank God for @ndlea_nigeria now saving people like you from death row https://t.co/8xKqKayJTE — Abike Dabiri-Erewa (@abikedabiri) October 17, 2022 Pipo reactions to Abike Dabiri-Erewa commentOne Former Minister of Information, Dr. Oby Ezekwesili dey among prominent Nigerians wey call her out over tweet. Dr Oby Ezekwesili say Dabiri-Erewa comment dey "messy" make she clean am up. Some odas for dia reaction drag di mata along politics, ethnic and moral upbringing line.

Dear Abike @abikedabiri , What is this? ????????‍♀️. Kai. This is messy. Please clean it up. Quickly. Please.✍???? https://t.co/TQ5lc1qIxv— Oby Ezekwesili (@obyezeks) October 18, 2022

Ode! You go to Indonesia, carry drugs, do cultism and come begging to be rescued from death sentence . Thank God for @ndlea_nigeria now saving people like you from death row https://t.co/8xKqKayJTE— Abike Dabiri-Erewa (@abikedabiri) October 17, 2022

I’m done on this . But out of respect for you , will ask, Clean what up? It’s okay for some untrained, uncouth guy to refer to me as “ mumu”, and I can’t call him “ ode”I’m not a public official that cows to bullying pls. https://t.co/iMl90BOdRN— Abike Dabiri-Erewa (@abikedabiri) October 18, 2022

Great quote to start the day ???????????? https://t.co/5TOuZsmg00— Abike Dabiri-Erewa (@abikedabiri) October 18, 2022

No one can get under my skin. I reply when I want to and say what I want to when I want to and when I have the time.And I will boldly say” I said what I said” ???????? https://t.co/047SxOr1xJ— Abike Dabiri-Erewa (@abikedabiri) October 18, 2022

????????????. These “shildren” are making me laugh self.Won gbadun ni ????????. https://t.co/N64zlxA7qx— Abike Dabiri-Erewa (@abikedabiri) October 18, 2022

Abi ooo. Only one day. That I had their time. They are running “ Kitikiti, Katakata”. Pls play me that Wande Cole song ????????Gentility No be stupidity ooo????????????????????????. https://t.co/5ONtxYkoMu— Abike Dabiri-Erewa (@abikedabiri) October 18, 2022

Read with your two eyes open. And with a bit of sense . Don’t be too “ obediently “ biased and beclouded. We’re you with us when we went up and down Indonesia begging them not to kill our people sentenced to death for drugs? https://t.co/rowX41OADw— Abike Dabiri-Erewa (@abikedabiri) October 18, 2022 Wetin dey happun for Indonesia According to di Nidcom boss, Abike Dabiri-Erewa, she say at least 16 Nigerians dey on death row for drugs related crimes for dia. Indonesia authorities don execute four Nigerians and di Nigerian goment don dey beg make di sentences dey commuted. But dem say dia law na dia law.

At least 16 Nigerians on death row there for drugs . 4 have been executed. We have been pleading that the sentences be commuted . But Indonesia says their law is their law https://t.co/z47NCdTJYI— Abike Dabiri-Erewa (@abikedabiri) October 17, 2022 Who be Abike Dabiri-Erewa? Hon. Abike Dabiri-Erewa na di Chairman Nigerians in Diaspora Commission. Abike na lawmaker, journalist and politician. She represent di pipo of Ikorodu Federal Constituency for di House of Representatives from June 2003 to June 2015, she serve as Chairman House Committee on Media and Public Affairs (June 2003 to June 2008). As Chairman House Committee on Diaspora Affairs (June 2008 till 2015), her major spotlight na her advocacy and calls for justice and fairness for Nigerians abroad. From China, Pakistan, Libya, to USA, Northern Cyprus, Saudi Arabia, Russia, Brazil and many more kontris, her intervention dey impactful. One ogbonge thing during her time as a lawmaker na say she champion and sponsor di Freedom of Information Bill (FOI bill) plus di Violence Against persons Bill and many odas, some of di bills don dey signed into law in Nigeria. She don receive many awards and recognitions. Di most recent na di National Honour of Officer of di Order of di Niger (OON) wey President Muhammadu Buhari just give her for a distinguished public and community both at di state and federal levels.

Source: BBC