BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Why Canada want 1.45m immigrants from 2023-2025

Justin Trudeau 98 Justin Trudeau

Thu, 3 Nov 2022 Source: BBC

Canada don reveal say dem dey expect to get 1.45 million immigrants to turn permanent residents for di kontri by 2025. Dis na as di Minister of Immigration, Refugees and Citizenship, MP Sean Fraser release plans on how immigration plans for UK go be between 2023-2025. Di plan na to get 465,000 permanent residents for di kontri for 2023, 485,000 for 2024 and 500,000 for 2025. Dis na as Prime Minister, Justin Trudeau tok for statement say, "last year, Canada welcome more than 405,000 newcomers enta di kontri, dis go be di be di most we don welcome in one year. We dey build on dat, and we dey set higher targets for di year ahead".

Canada don reveal say dem dey expect to get 1.45 million immigrants to turn permanent residents for di kontri by 2025. Dis na as di Minister of Immigration, Refugees and Citizenship, MP Sean Fraser release plans on how immigration plans for UK go be between 2023-2025. Di plan na to get 465,000 permanent residents for di kontri for 2023, 485,000 for 2024 and 500,000 for 2025. Dis na as Prime Minister, Justin Trudeau tok for statement say, "last year, Canada welcome more than 405,000 newcomers enta di kontri, dis go be di be di most we don welcome in one year. We dey build on dat, and we dey set higher targets for di year ahead". Last year, Canada welcomed more than 405,000 newcomers – the most we’ve ever welcomed in one year. We're building on that and setting higher targets in the years ahead, because immigration is critical to growing our economy and helping businesses find the workers they need.— Justin Trudeau (@JustinTrudeau) November 1, 2022 According to di plan statement wey, oga Fraser arrange, Canada dey gbab almost all dia labour force growth na from immigrants wey dey enta di kontri. Even dia census bin note say every 1 in 4 pipo for di kontri na landed immigrant or permanent resident. Canada na currently di kontri wey get di largest proportion of immigrants among di G7 kontris. Di reason dem dey give na sake of shortage in labour as well as Canada aging population. Who fit enta Canada with dis new plan - New features o di Express Entry System go welcome new comers wey get skill and qualification for health care, manufacturing, building trades and STEM (Science, Technology, Engineering and Math) . As na wia labour shortage dey - At least 4.4% of new permant residents outside Quebec go be Francophone - Those wey dey face prosecution for wia dem dey from come from How pipo don dey japa from Nigeria Nigerians wey dey comot from di kontri don plenty – no be say na new tin but di number of pipo wey come japa don increase. Di most popular kontries wey Nigerians dey run go na UK, America, Canada, Australia, New Zealand and some oda foreign kontris. Some pipo dey quit dia work, sell dia property or even borrow money to fit leave Nigeria. “Di economic situation bad and di hardship don make pipo lose hope for Nigeria sake of bad goment,” na so Aisha Yesufu, one rights activist tell BBC Pidgin. But some times, e no dey turn out well for pipo wey dey japa. One BBC investigation show evidence of how one British healthcare company dey employ doctors from Nigeria to work for private hospitals under conditions wey no dey allowed for di National Health Service. Doctors wey dem employ from some of di world poorest kontris go work for UK hospitals dey complain of exploitation. One UK report show say Nigerians na im get di most number of dependents wen dem dey enta Britain to study. Why Nigerians dey japa 'Japa', na Yoruba language wey mean 'to run away'. E don become popular slang especially among Nigerians wey don tire to endure di situation for di kontri. Yesufu say true-true pipo dey leave Nigeria for beta life abroad, dem dey also contribute to di economy of di kontris dem dey. Many pipo dey leave Nigeria sake of; - High rate of insecurity - Poor healthcare leading to careless deaths - Failure in di education system - No light and di effect on small businesses - Economic collapse - Human right violation - Di activist throw blame give foreign kontris wey dey encourage corruption for Naija leading to bad governance. Howeva e don easy pass for some areas like Canada sake of need for labour.

Source: BBC