Menu

Why Edo State House of Assembly summon Tuface wife Natasha Irobosa to come explain hersef

Natasha Irobosa.png Natasha Osawaru Irobosa bi di wife of Tuface Idibia

Wed, 3 Dec 2025 Source: BBC

Di Edo State House of Assembly don summon di wife of Tuface Idibia, Hon Natasha Osawaru Irobosa to appear bifor di House Committee on Ethics and Privilege.

Hon Natasha, wey dey represent Egor Constituency for di Edo State House of Assembly, chop accuse say she dey drag di House into rofor-rofor.

For plenary on Tuesday 2 December, Speaker Blessing Agbebaku say Honourable Natasha don dey trend negatively on social media.

E say di lawmaker gatz appear bifor di House Committee on Ethics and Privileges within one week to explain hersef.

"Honourable Natasha Irobosa gatz appear bifor di di Ethics and Privileges Committee to let us know why she dey drag di House into rofor-rofor," Speaker Agbebaku tok.

Di Speaker also tok say Honourable Natasha go also explain why dem no go take disciplinary action against her and ask di Committee to report back to di House on dia findings within two weeks.

Honourable Natasha never comment on dis invitation by di House.

Wetin don happun bifor now?

Tuface Idibia and Natasha Osawaru don become major topic of discussion across social media platforms.

Di couple begin trend afta one gbas-gbos between dem during Instagram Live session wey media personality Daddy Freeze bin host. Di moment bin go viral around di same time one old video emerge online, wey claim say di singer chop arrest for di United Kingdom afta agbas-gbos wit Honourable Natasha.

During di Daddy Freeze live broadcast, wey bin feature several guests including some of Tuface former associates, di singer join briefly. Afta e appear, gbas-gbos between am and Natasha start on camera, and e lead to im sudden exit. Daddy Freeze share di clip on im Facebook page on Monday 1 November.

Around di same time, di alleged arrest video emerge on social media, wey show officers dey speak wit 2Baba outside wetin be like retail store.

Wen BBC News Pidgin reach out to Met Police to confam di arrest, dem say dem no dey respond to queries about pipo wey dem neva charge.

Who be Natasha Osawaru?

Her name na Natasha Irobosa Osawaru but pipo dey call her Honourable Natasha.

She be politician and a member of di Edo State House of Assembly. She be member of Peoples Democratic Party (PDP).

Details from di Independent National Electoral Commission (Inec) say Natasha come from Egor Local govment area of Edo State, Southern Nigeria.

Dem born am on November 14, 1994.

Currently she be di Deputy Majority Leader of di Edo State House of Assembly, representing Egor Constituency.

Natasha get law degree from Igbinedion University and later get Master's degree in Film Production from Full Sail University, United States.

Bifor she join politics, she bin dey advocate for youth and women development.

She also focus her energy on advocating for policies wey go promote economic growth, social welfare, and infrastructural development for Edo State and Nigeria.

Di couple for November welcome dia first pikin togeda since dia marriage.

Honourable Natasha on her Facebook page write, "Congratulations to Mr & Mrs Idibia. We joyfully welcome our bouncy baby boy into di world

"May this precious little one bring endless laughter, happiness, and blessings to our beautiful family. wit love, strength, and unforgettable moments as we begin dis wonderful new chapter. Welcome, baby boy Idibia."



  • How fans and celebrities react to Tuface and Annie Idibia separation
  • Who be Natasha Osawaru wey Tuface dey tok about?
  • Fame dey lower life expectancy for musicians - study


Source: BBC