BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Why Egyptians para ova black Cleopatra for Netflix feem

Queen Cleopatra dey played by British actress Adele James

Sun, 23 Apr 2023 Source: BBC

One Netflix docudrama series wey show Queen Cleopatra VII as black African don cause kasala.

One lawyer from Egypt don file complaint wey dey accuse di show episode, African Queens: Queen Cleopatra say dem violate media laws and wan "erase di Egyptian identity".

One ogbonge archaeologist tok say Cleopatra bin dey "light skin not black".

But di show producer say "her heritage dey highly debated" and di actress wey dey play her tok say, "if you no like di casting, no watch di show".

Adele James tok dis one for Twitter as she screengrab plenti abusive comments wey get racist insult sef join.

Dem born Cleopatra for di Egyptian city of Alexandria for 89 BC and na she be di last queen of di Greek speaking dynasty wey Alexander di Great im Macedonian General Ptolemy start.

She follow her papa Ptolemy XII for 51 BC and rule until she die for 30 BC. Afta her death, Egypt fall under Roman rule.

No body know who born Cleopatra and historians say e possible say her mama or any oda female ancestor na original Egyptian or from anoda part of Africa.

Netflix sister website, Tudum bin tok for February say, di reason dem cast Adele James wey be British actress of mixed race as Cleopatra na "respect to di century old tok-tok on di ruler race".

Jada Pinkett Smith wey be di executive producer and narrator don dey quoted say, "we no dey always see or hear stories about black queens and e dey very important to me and my daughter make our community sabi dia tori and know say dem plenti".

But wen di trailer drop last week, many Egyptian no gbadun how Cleopatra bin look.

Oga Hawaa say di only Egypt rulers wey dem sabi say dey black na di Kushite kings from di 25th Dynasty (747-656 BC).

E add say "Netflix dey try cause confusion by spreading false and deceptive facts say di origin of Egyptian civilization dey black" and come ask make Egyptians stand up against di streaming company.

On Sunday, lawyer Mahmoud al-Semary file complaint give public prosecutor make e take "di necessary legal measures" and block access to Netflix for Egypt.

E allege say di series include visual material and content wey violate di kontri media laws and accuse Netflix say dem dey try "promote di Afrocentric thinking wey include sayings and writing wey wan scata and erase di Egyptian identity".

Three years ago, plans for feem about Cleopatra wey get di Isreali actress Gal Gadot create social media fight say di role suppose be for Arab or African actress.

Gadot defend di casting say, "we bin dey find Macedonian actress for Cleopatra. She no dey and I dey very passionate about Cleopatra."

Source: BBC