Barbados prime minister Mia Amor Mottley bin thank Ghana president say im gree to export nurses
For some parts of Africa, pipo bin dey try to leave dia kontri to find wetin dem call ‘greener pastures’.
In Nigeria and Ghana, dem dey call am ‘japa’.
From normal workers for public and private sector to oda specialists, di numbers bin dey rise.
For di health sector, in 2023 alone, almost 2,000 critical staff wey include doctors, midwives, nurses, administrative staff and odas bin leave dia post.
Di Ghana health service data bin show say dis pipo wey japa for dat year, include those wey take leave without pay, those wey resign and odas wey just leave dia post.
Pesin fit chat dia friend today, di next two days im go tok say im travel go Europe or America.
For Ghana, since 2019, one agreement between di kontri and Barbados don create way for Ghana to send dia nurses to di Caribbean nation to work.
Dis one follow appeal wey di prime minister of Barbados Mia Amor Mottley bin make to Ghana President Nana Akufo-Addo say make im allow some of di nurses for di kontri to enta Barbados.
According to di prime minister, di Caribbean kontri short nurses and oda healthcare workers.
Im add say, “e dey sweet me say di first batch dey do dia work well well wey help our public health system to di extent say we don interview anoda 200 nurses wey go enta Barbados for further.”
At di time dis arrangement don dey happun, pipo begin to bash di goment say make dis nurses stay for di kontri and help Ghanaians.
But di deputy minister for health at di time, Alexander Abban tok say e go beta say make di kontri send those nurses abroad, sake of di salary wahala wit di Ghana health service.
Five years afta di agreement, time don reach to select di third batch of nurses wey go go Barbados.
“BLS (basic life support) and ACLS (advanced cardiovascular life support) certificates dey required for registered nurses wey dey apply for dis opportunity.”
Leader of di Ghanaian nurses for Barbados, Dela Arthur-Mensah tell BBC Pidgin say di nurses “get to also prepare dia mind say dem dey go serve for anoda kontri wit different pipo and different ideology.”
Im add say, “even though dem no dey used to dis kind system, di nurses get to prepare to take up new roles as well as experiences wia wahala too go come but dem get to face dem.”
According to di application portal, Barbados bin dey look for dis category of nurses - nursing officers, midwifery officers, critical care nurses, accident & emergency nurses and anaesthetic nurses.
Di oda categories na neonatal nurse practitioners, theatre nurses, staff community psychiatric nurses, community health nurses, staff mental health nurses among odas.
Some of di nurses bin dey house for more dan three, four years wia goment neva employ dem for di public sector.
Some of dis unemployed nurses ova di years don organize demonstrations say make di health ministry employ dem for di system, but di ministry of finance wey get to give di clearance for dia employment bin dey tok say dem go do am, but e neva happun.
Na so some of di nurses already try to dey find dia own means to japa.
Wit dis Barbados agreement, as di nurses don dey go di Caribbean kontri for dia 2-year renewable contract, space don dey for di Ghana health system to fit employ some of di unemployed nurses.
Di salary structure also dey according to years of experience and certificate.
For dis nurses in Barbados, dia monthly salary dey range between $1200 - $3000, according to tori from Ghana officials wey bin dey facilitate dis project.
At a time Ghana dey suffer economic crisis, dis moni na plenty moni wia sabi force di nurses to stay for dia.
Some of dem even dey carry dia family members to join dem for dia.
So far, di nurses don adjust to di work system and life for di Caribbean kontri.
“Di environment dey feel like home, but di challenges also dey every day, but we still dey conquer am and e don dey add to our experience for hia,” Dela tok BBC pidgin.
Im tok say “ wit time, di new nurses wey go come, go adjust, everibodi get dia own coping mechanisms but I sabi say wit time dem go be okay.”
“To dey adjust to di work routine and sleep time go happun small small.”