BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Why Supreme Court troway UK goment plan to send asylum seekers go Rwanda

Flag Rwanda G Rwanda flag

Wed, 15 Nov 2023 Source: BBC

Di British Government plan to deport migrants go Rwanda dey unlawful, di Supreme Court don rule.

Di Supreme Court president, Lord Reed for im opening statement tok say: "No legal rule dey wey say dem must return refugees go dia kontri of origin if dia lives go dey threatened for dat kontri."

Lord Reed tok say plenty grounds dey to believe say genuine refugees dem send go di kontri fit dey at risk of being returned to kontris from wia dem bin run from wia dem fit dey subject to inhumane treatment.

For inside one unanimous decision, di five top justices tok say di Court of Appeal bin dey right to conclude for June say proper assessment no dey of whether Rwanda dey safe.

Source: BBC