Apple say di reason why di new iPhone 15 dey overheat na sake one bug for dia operating system and updates to apps like Instagram.
Since di latest model of di smartphone go on sale for September, some users dey complain say di devices dey hot well-well to touch.
Apple say e get one bug wen dem update iOS 17 for di phone.
But dem also claim say changes to third party apps dey "cause dem to overload di system".
iPhone users dey used to di fact say dia devices go hot during dia initial set-up or wen dem dey do back up, sake of di amount of processing power e dey use and di handset dey work overtime - but these issues wit iPhone 15 dey worse.
Users enta social media to complain say di new phones dey hot.
iPhone 15ProMax in the blue titanium. It gets extremely hot to the point where I can't even hold it. Additionally,it gets hot after being on a FaceTime call for just 2 minutes. My previous iPhone never had this issue, never experienced this level of heat.#apple #iPhone15ProMax pic.twitter.com/gL649xG98l
— Amit raj singh chawla (@Amitrchawla) September 24, 2023
E say "anoda issue involve some recent updates to third-party apps wey dey cause am to overload di system," dem add say dem dey work wit app developers to fix am and dem dey on top di mata to roll am out.
Among di apps dem blame for di problem na Instagram, Uber and di video game Asphalt 9, according to Apple.
Already Instagram don fix di issue wit dia app last week.
Di upcoming iOS 17 bug fix no go reduce performance in order to address di iPhone temperature.
Apple say di warm phones no get anytin to do wit di new titanium casing wey dey house di iPhone 15 Pro and iPhone 15 Pro Max instead of di stainless steel wey dem bin use on older smartphones.
Dem also say di overheating problem no get anything to do wit di new USB-C port wey dem gatz comply wit sake of di new law by European regulators.
Apple say di issue no be safety or injury risk dem add say e no go affect di phone long-term performance.
How much be di new iPhone?
Di iPhone 15 go start at £799 and di iPhone 15 Pro go start at £999 for di UK.
"Convincing users to buy dis new devices no go dey easy during a cost-of-living crisis," Paolo Pescatore tok. Na analyst and founder of PP Foresight. "Some pipo go see di new features as incremental, [although] collectively dem enhance di overall experience wey dey priceless among Apple's core user base."
Apple shares bin go down slightly on Tuesday, and di firm fail to reverse one sharp drop wey happun last sake of say reports tok say di Chines goment don ban officials from using iPhones.
Huawei's release of one new smartphone series for China cause investor to panic.
Di global smartphone market don slump from shipping 294.5 million total phones to 268 million for di second quarter of 2023.
But Apple shipments fall no too fall compared to major smartphone makers. Apple shipments drop from 46.5 million phones to 45.3 million, according to analysts Counterpoint Research.