Some theories dey point say phones and oda gadgets fit affect di electronic systems
You carry yourself, pay plenti money enta aeroplane either bicos di road no safe or you need to go wia you dey go fairly sharparly.
You siddon, dem do all di safety tok-tok, to wear belt and den di pilot tell you say time don reach to off your phone, but you dey play games or watch video, but not for di first time, you ask your sef why I dey run dis parole?
Some theories dey point say phones and oda gadgets fit affect di electronic systems.
According to regulations wey resemble demselves worldwide, electronic devices no suppose to stay on under 3,000m (10,000ft), even if e dey in flight mode.
But above dat height from di ground pipo fit use laptops or music players but di phones go still dey off.
Di US Federal Aviation Administration ban cell phones for airborne use howeva bicos say e fit interfere wit aircraft instruments. Dem say "devices fit dey used for airplane mode or wit cell connection off. You fit use WiFI connection on your device if di plane get WiFI system and airline allow di use."
Di US constitution tok say "di use of cellular telephones while di aircraft dey airborne dey prohibited by FCC rules".
BBC tori pesin, Katia Moskvitch tok say personal phones fit act to malfunction aeroplanes bicos of dia electronics based systems wey dem dey call avionics.
Dis avionics na wetin det used for navigation, to tok wit pipo for ground and monitor wetin dey keep di plane for air and some of dis components dey use sensors to take give informate to di cockpit.
So na how phones fit affect di information wey di plane dey get. No be just phone sha o, Kindles, laptops and handheld gaming consoles bicos all of dem dey comot radio waves.
If dis waves dey at frequencies wey dey close to di ones di avionics dey emit, e fit corrupt di signals and readings wey dem dey provide.
If dis sensors no work, e fit affect systems like radar, communications and collision avoidance technology.
Di problem fit rise well well if your devices don spoil and dey comot stronger radio waves or if di signals from multiple device combine.
No record don show say crashes don dey directly linked to phone use interference but sometimes pesin no dey know wetin dey cause di accidents.
Flight recorder fit no show say critical system bin fail bicos of electromagnetic interference from passengers devices.
However, even though straight line no dey between crash and use of electronic devices.
Katie reveal say US Aviation Safety Reporting System wey Nasa dey maintain show 50 cases of safety issues wey phone use cause.
One case report tok say, "First Officer report say compass systems bin get k-leg for initial climb. Wen dem ask passengers to make sure say all dia devices bin dey off, di compass system go back to normal."
One 2006 analysis of di data base show 77 times wey dey highly link interference from electronic gadgets.
Di International Air Transport Association (IATA) show 75 separate incidents wey pilots believe say na phones cause electronic interference between 2003 and 2009.
BBC tori pesin, Katia Moskvitch point out say even though some airlines don dey advertise how dem go allow pipo to use dia phones for flights, no be for wen di plane dey take off or land, na just for wen di plane dey cruising altitude.
Wetin you fit do or not do in plane
BBC News Pidgin reach out to di Director, Public Affairs & Consumer Protection for di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA), Michael Achimugu on wetin be di aviation regulations wey dey guide airline passengers, and e list di offences wey include but no dey limited to di following;
Smoking for inside plane or for non-smoking area of di terminal building na offence.
Use of mobile phones and/or oda communication/electronics gadgets inside plane without di approval of di aircraft Commander na offence.
Fighting or oda disorderly conduct for inside plane or for di terminal building na offence.
Any conduct/act wey constitute nuisance to oda passengers na offence.
Disobedience of lawful instructions issued by di aircraft commander, flight crew, cabin attendants, check-in staff and/or security screening staff na offence.
Any conduct wey endanger or wey dey likely to endanger di safety of flight operations na crime.
Tampering wit smoke detectors and oda aircraft equipment na crime.
No pesin dey allowed to carry, or attempt to carry, weapons, prohibited items or oda dangerous devices for body, or for inside im load for plane unless e dey authorized for transport.
No pesin go dey allowed to enta security restricted area or sterile area unless di aviation security officer don screen and clear am for entry.
Na crime to take pictures or videos for restricted areas for di airport terminal
Carry Prohibited Items:
Items like sharp objects, flammable liquids, or certain electronics dey restricted and security go seize am.
Di Nigeria Civil Aviation Authority regulations allow di aircraft commander or airport authority to take di necessary measures wey include restraint wia necessary wen dem see any passenger wey dey misbehave on board or for di terminal building.
NCAA also list offences and di penalty for inside airplane or for terminal area.
Operating a portable electronic device in violation of crew directives go attract - Maximum civil penalty
Drinking alcoholic beverages wey no be di operator serve - Maximum civil penalty
Interference wit crew member go attract - Maximum civil penalty
Physical assault or threat to physically assault a flight or cabin crewmember go attract - Minimum to maximum civil penalty and/or criminal referral
Physical assault or threat to physically assault an individual wey no be crewmember - Minimum to maximum civil penalty and/or criminal referral.
Traveller wey act in a manner wey pose imminent threat to di safety of aircraft or oda individuals on di aircraft go face - Minimum to maximum civil penalty and/or criminal referral.
Smoking for area wia dem write or put "No Smoking' sign - Maximum civil penalty.
Smoking for aircraft lavatory - Maximum civil penalty.
Tampering wit smoke detector - Minimum to maximum civil penalty and/or criminal referral.
Refusal to fasten seat belt for wia seat belt sign dey - Minimum to moderate civil penalty.