BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Why e hard for public officers to resign for Nigeria

Screenshot 2024 08 25 154007.png Director General of di National Intelligence Agency (NIA) Ahmed Rufai Abubakar

Sun, 25 Aug 2024 Source: BBC

Even though President Bola Tinubu don approve and accept di resignation of di Director General of di National Intelligence Agency (NIA) Ahmed Rufai Abubakar on Saturday pipo still dey ask questions.

Dis na sake of say resignation no be wetin dem dey see evriday for Nigeria. E no common to see or hear say public officers resign for Nigeria.

Na why di resignation of di Director General of di National Intelligence Agency resignation shock pipo and e still dey trend for social media. Pipo still dey tok about di mata.

Emeka Ihedioha resign from 'weak' opposition PDP

Finidi George confam resignation as Super Eagles coach

Resignation galore for Fubara cabinet afta govnor sign N800bn 2024 budget into law - Latest from Rivers State political crisis

Wetin really happun?



Di now former Director General of di National Intelligence Agency bin go di Presidential Villa on Saturday wia e submit im resignation letter.

E submit im letter of resignation afta e get small meeting wit President Bola Tinubu wia e brief am about issues of National Intelligence.

Di former NIA boss Abubakar tell tori pipo on Saturday afta im meeting wit President Bola Tinubu say, im discuss wit Tinubu wey understand wit am.

Abubakar tok say im come to visit Tinubu to “brief Mr President on issues and today no dey different.”

“Afta di briefing, I tender my resignation and Mr President graciously approve and accept di resignation.”

Di former NIA boss He thank President Bola Tinubu “for di opportunity e give am to serve Nigeria under im transformational leadership for an extended period of 15 months – e no dey common to get dis veri rare opportunity to serve two presidents at a stretch.”

Oga Abubakar say im go remain professionally dedicated to Nigeria.

Why NIA boss resign



Di former NIA boss tell tori pipo say notin dey serious to worry about im resignation.

Im tok say im resign sake of some personal and family issues, but im no tok di main reason.

“Plenti reasons dey wey fit make pesin take di decision. Some personal, family issues. But nothing veri serious actually.

“I discuss wit Mr. President, im understand veri well, and I promise to remain steadfast wit issues and di security situations of di kontri,” im tok.

Abubakar, wey be 71 years old na retired career foreign service officer from Katsina State.

E join di security department of di Nigerian Foreign Service for 1993.

For 2015, dem appoint am as di senior special assistant to di president (SSAP) on international relations and foreign affairs.

Im go Bayero University for Kano, wia e get bachelor’s and master’s degrees in French. Im dey also speak English and Arabic.

Na former President Muhammadu Buhari appoint oga Abubakar as di NIA boss for 2019. Im extend im time for office to December 2021.

Oda pipo wey don resign for Nigeria



Even though resignation no dey common for Nigeria e get some pipo wey don resign dia position bifor.

Kemi Adeosun: For November 2015, President Muhammadu Buhari bin appoint Kemi Adeosun as di Minister of Finance.

On 7 July 2018, local tori pipo bin allege say Kemi Adeosun use mago-mago to get her mandatory National Youth Service Corps (NYSC) exemption certificate to enta public office.

On 9 July, di Director of Press and Public relations Adeyemi Adenike bin release statement wey confam say Adeosun bin legitimately submit one request to get exemption certificate.

Im also tok say investigations still dey go on to verify di approval of di exemption certificate.

On 14 September 2018, Adeosun resign as Minister of Finance, she bin write letter to di President sake of di alleged NYSC Certificate forgery scandal.

Patricia Etteh: Na Nigerian lawyer and politician, former 10th speaker of di House of Representatives for Nigeria from June to October 2007.

For September 2007, she bin face one committee sake of accusations say she bin give permissions make dem spend 628 million Naira on renovations of she and her deputy official house.

Dem also tok say she buy12 official cars for di House of Representatives. Dem begin accuse her of tiff-tiff and security bin escort her out.

Sake of too much pressure Etteh resign her position as speaker. Her deputy, Babangida Nguroje, bin also resign.

Rivers state: For Rivers state mass resignation of political officers bin happun.

Five cabinet members bin tender dia resignation letters to Govnor Siminialayi of Rivers State on Thursday 14 December, 2023

Di state attorney general and commissioner for justice, Professor Zacchaeus

Adangor for im resignation letter bin say im dey leave di goment sake of im personal principles as Resignation galore bin happun for Fubara cabinet afta govnor sign N800bn 2024 budget into law - Latest from Rivers State political crisis

Super Eagles Coach:

Recently Finidi George resign from im position as Super Eagles Head Coach.

Im resign afta di NFF bin tok say dem go hire one foreign technical director for di Super Eagles as Finidi George confam resignation as Super Eagles coach.

script>!function(s,e,n,c,r){if(r=s._ns_bbcws=s._ns_bbcws||r,s[r]||(s[r+"_d"]=s[r+"_d"]||[],s[r]=function(){s[r+"_d"].push(arguments)},s[r].sources=[]),c&&s[r].sources.indexOf(c)<0){var t=e.createElement(n);t.async=1,t.src=c;var a=e.getElementsByTagName(n)[0];a.parentNode.insertBefore(t,a),s[r].sources.push(c)}}(window,document,"script","https://news.files.bbci.co.uk/ws/partner-analytics/js/fullTracker.min.js","s_bbcws");s_bbcws('syndSource','ISAPI');s_bbcws('orgUnit','ws');s_bbcws('platform','partner');s_bbcws('partner','ghana.web');s_bbcws('producer','pidgin');s_bbcws('language','pcm');s_bbcws('setStory', {'origin': 'optimo','guid': 'c5ydlz8e9jyo','assetType': 'article','pageCounter': 'pidgin.articles.c5ydlz8e9jyo.page','title': 'Why e hard for public officers to resign for Nigeria','published': '2024-08-25T12:53:58.154Z','updated': '2024-08-25T12:53:58.154Z'});s_bbcws('track','pageView');

Source: BBC