Di late Nigerian singer Ileroluwa Imole Aloba AKA. Mohbad
Papa of di late Nigerian singer Ileroluwa Imole Aloba AKA. Mohbad say na till authorities determine wetin kill im son, na im dem go bury am.
Mr. Joseph Aloba for exclusive interview wit BBC Pidgin accuse authorities say dem dey play wit di case and no wan allow justice take im course.
Singer Mohbad die for 2023 after one incident for im house for Lagos state. Dem bin bury am almost immediately but authorities later exhume di body to find out wetin kill am.
Im death na one wey touch many Nigerians and spark a call for justice following reports wey allege say e suffer bullying, harassment and assault as a musician wey bin dey signed under di music label Marlian records.
Di record label owner, wey also be popular musician Naira Marley don deny dat accuse and authorities dey investigate di circumstances leading to im death and also di claims of bullying and harassment.
'Dem shutdown di coroner inquest'
"I no dey happy how pipo for authority handle Mohbad case. Wen pesin die, dem suppose question pipo wey dey around am dat time, but dem no do am. We are in di modern age, even phone forensic, goment fit do am, but dem no do," na so Mohbad papa tok.
E say "di injustice wey I dey face inside, e fit kill me. Na unto say I no wan make e kill me, na im make me come out to speak my mind so dem go fit save me".
E disclose say at some point wen di authorities say dem send im sample outside di kontri to do autopsy and toxicology, im too send somebody to check am out for abroad, but di person say dem no see any sample of Mohbad for dia.
"I dey call on di goment make dem handle dis case properly. I want to know what killed Mohbad and secondly, I want to know di paternity of im baby" na wetin e tok.
Authorities don shutdown di coroner inquest for a while now via court order and stop all di matter wey dey go on about death of di singer, but Mohbad papa feel say di right tin to do na to open and continue di coroner inquest so dem go fit finalize di case and im go go bury im child.
Mr Joseph say, "I dey beg di Lagos state goment make dem open di coroner inquest back, so dem fit finish di case in time. Without di coroner inquest, dem no fit show di results of di autopsy, I bin request for private autopsy, di result don dey down but I no fit tok wetin di result tok, only di coroner fit tok am".
According to am, some pipo say dem want to be joined to di case, say na sake of dose pipo, dem shutdown di coroner for like six months now.
'I no dey happy say im body still dey mortuary'
Mr Aloba wey dey sad during di interview describe how e dey feel as dem never bury im son wey dey mortuary.
"I no dey happy say im body still dey mortuary since den, as a Yoruba man, e no suppose stay dia reach now, e be just like a baby to me. So I dey wait make goment open di coroner inquest make I know wetin kill Mohbad," na so e tok.
Wen our reporter ask am whether na till dem determine wetin kill am, na im dem go bury di singer, e say "yes, na wetin I dey wait for".
Wen our reporter query am say e be like im turn di investigation into media circus and dey take advantage of di whole situation, e say "no be true, wetin I dey find na justice for my pikin but dem dey play me like football".
E say e petition police about di pipo im dey suspect wey kill im son, say make police interrogate dem, help me ask dem question, but di police no gree. Dem say person wey go sign no dey around.
On di DNA palava
E chook mouth into di issue of Mohbad little son, say e wan confirm di paternity of di baby.
Mr Joseph wey also be singer imsef say "dem neva do di DNA, dat case dey court. I no doubt di baby at first, na during di coroner hearing two of Mohbad friends begin tok say na di baby cause fight between Mohbad and im wife, say Mohbad dey complain of di paternity of di baby".
"And di baby mama accuse me say na sake of say im no give me di baby placenta na im make me no be her friend again. So I come dey think say if me no collect di placenta and Mohbad no hold am, so who come hold am? So I want to know who get di baby" na wetin e tok.
According to am, "dem suppose carry di baby give me to go check am out, but dem no do dat one. Dem say make I go collect court order, I don go get am, but di lawyer wey handle di case, I no like wetin e do, so I wan change di lawyer."
Meanwhile, ontop di DNA matter, Mohbad wife Wunmi Aloba bin don say she ready to do di DNA test since but di father side wey suppose show face neva show for dem to do am.
Wunmi wey tok to BBC through her lawyer say dem go go ahead to do di DNA test if di papa no ready to step forward to make di process fast. E add say dem go serve di father side wit notice and if dem no show up, dem go go ahead.
Mr Aloba describe im son say, "Mohbad na my friend, very quiet, very caring, my son my second, I name am Oladimeji wey mean my second. E dey like a shock. I miss am a lot".
"If I see am like dis and e say e no like dis shoe, e go go get me new shoe. If e no like my cloth e go change di cloth. If no be sake of friends wey dey around and dey make provisions for me, I for don dey die inside," na wetin e tok.
A verified source from di police tell BBC say police don do dia work finish and everything now dey for di hand of di judiciary and if di judiciary invite police to come testify, police go come.
Mohbad papa
Mohbad and im wife