Madagascar President Andry Rajoelina
Madagascar President Andry Rajoelina wan address di island nation on Monday evening afta sojas turn against im goment wit attempted coup to grab power from am.
Rajoelina go address di nation on national television, e neva clear wetin e wan tok about but im don already accuse di military of controlling di nation affairs.
On Sunday, di office of President Rajoelina tok say di military attempt to seize power and illegally force am out of goment.
Hours later, one army unit wey pipo sabi as CAPSAT claim say dem don take ova di leadership of di military command, and na dem dey in control of all di armed forces - land, air, and naval.
Wia Madagascar dey for Africa continent
Madagascar na one of di four biggest island in di world and e dey for di southeast coast of Africa.
Malagasy dey popular for dia aquaculture and agriculture wey be di primary source of income for di nation.
Locals in di nation also focus on natural resources and tourism industry to drive di nation economy but despite dis many still dey live in poverty.
Dem gain independence from France in di year 1960 and di nation don experience many political instability.
Di Capital of di nation na Antananarivo, dem get population of about 31 million pipo and di official language na Malagasy, and French.
Currently na President Andry Rajoelina be di president of di kontri. E dey serve im third term for office afta im win di recent election in 2023.
Many believe say dem rig di election even though e get 59% of di votes - to beat im two closest rivals, former President Marc Ravalomanana and Siteny Randrianasoloniaiko.
Rajoelina don rule di kontri for four years, e later return to power afta di 2018 election. Di protests mark di most significant challenge e don face since im re-election for 2023.
Despite dia natural resources, Madagascar na one of di poorest kontris for di world. 75% of dia pipo dey live below di poverty line, according to di World Bank.
Only about one-third of Madagascar 30 million pipo get access to electricity, according to di International Monetary Fund (IMF).
Wia di president of Madagascar dey?
Rajoelina whereabouts still dey unclear, but inside one statement e tok say "Attempt dey to seize power at dis time in di territory of di Republic, in complete violation of di Constitution and democratic principles," afta translation.
Di 51-year-old Rajoelina enta power afta di 2009 coup wey force den President Marc Ravalomanana out of di nation and power. Dem elect Rajoelina as president in 2018 and re-elect am for 2023.
Since Madagascar don gain independence from France in 1960, dem don commot several leaders from power.
Why young pipo dey protest for Madagascar
On September 25, young Malagasy gada for anti-govment protest for Antananarivo, Madagascar. For di past three weeks now, dem don dey protest against di lack of water and power.
Di group wey many sabi as "Gen Z Madagascar" na dem dey lead di protest wit anger ova lack of water and electricity.
Although, di demonstrators neva issue any manifesto about wetin dem want but dem dey demand political change and betta welfare for Malagasy pipo.
Many of di young protesters dey faced wit insecure and poorly paid jobs and dem don call for di president resignation - dem blame am for dia problems.
UN tok say about 22 pipo don die and more dan 100 pipo injure for di protests, but di govment reject di figures, dem say di figures na based on "rumours and misinformation".
Since di kasala don happun, many political actors including former President Marc Ravalomanana, don come out in support of di protesters.
E tell BBC say di biggest problem wit Rajoelina na say "e no dey listen".
Di protests since don spread beyond Antananarivo, e happun for eight oda cities across di island, and signs no dey say e go end.
Protesters wey dey wave banners, don condemn di blackouts and dem accuse di govment say dem fail to guarantee basic rights.
"As long as Rajoelina remain for power, we go continue di struggle," Gen Z Mada tok for inside one statement.
Activists also blame widespread corruption within di power company for di electricity wahala.
Who be di military stakeholders wey wan attempt coup
On Saturday di military unit, CAPSAT hijack di protest and ask president Rajoelina and im cabinets make dem leave office.
Di same unit, help Rajoelina hijack power as transitional leader in di military-backed coup in 2009, and dem tok say dem dey in-charge of all di armed forces in Madagascar.
On Sunday, Rajoelina office tok say, "Attempt dey to seize power illegally and by force."
CAPSAT na military unit for Madagascar and dem don appoint new army chief of staff, Gen Demosthene Pikulas as di new head of Madagascar armed forces, , according to one statement on dia Facebook page.
Commander of CAPSAT, Col. Michael Randrianirina, tok say di army don respond to di pipo call but deny any coup attempt .
E tok say na only Malagasy pipo go decide wetin go happun next and if Rajoelin go comot from office and anoda election go hold.