BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

How teenage girl kill fellow pupil and herself for school

Area wia di incident happun

Thu, 7 Dec 2023 Source: BBC

One teenage girl shoot and kill her fellow pupil inside one school for western Russia before she shoot herself.

Di attack happun for di city of Bryansk, close to di Ukrainian and Belarusian borders, on Thursday morning.

Five pipo wound for di shooting, one of dem get serious injury, Russian authorities tok.

Di gun wey di girl girl use dey registered wit her papa name, one parliamentarian tok.

Dem call Police to di Gymnasium No 5 for Bryansk at about 09:15 local time (06:15 GMT) on Thursday.

Alexey Kuznetsov, Russia deputy health minister, say one victim dey undergo surgery.

Police believe say dem fit don bully di girl for school.

Plenti school shootings bin don happun for Russia in recent years, although dem believe say di incident on Thursday na di first wey dey involve a female shooter.

For 2021, one 19-year-old kill seven children and two adults for one Kazan school.

Di following year, dem kill 18 pipo for one school in Udmurtia.

No be only for Russia wey school shootings don happun wey involve teenagers.

For March 2023, one six-year-old boy shoot im teacher for one primary school for di US state of Virginia.

Police bin tok say di pikin bring gun inside im backpack to Richneck Elementary School on 6 January.

Authorities for di city of Newport News bin neva decide if any adult go face criminal charges for di case.

Di boy bin shoot Abigail Zwerner wey be 25-year-old teacher for hand and chest but she survive am.

For Nigeria, one secondary school student bin carry gun go school for 2021 to shoot her teacher sake of say di man ask am to barb her hair.

Di girl carry locally-made gun go Government Secondary School for Akpabuyo, Ikot Ewa, Cross River State.

Charles say as di young girl resume school, her class teacher ask her to go barb her coloured hair wey she carry come school.

Source: BBC