Menu

Supreme Court for UK go deliver verdict on di meaning of woman

Screenshot 2025 04 16 110010.png Di legal argument dey come at di time of debate on gender issues

Wed, 16 Apr 2025 Source: BBC

Di UK Supreme Court go deliver verdict on how dem go define woman in law.

Di announcement mark di culmination of long-running legal battle between di Scottish goment and one women group.

Di outcome fit get far-reaching implications on how sex-base rights apply across Scotland, England and Wales.

Di Scottish goment argue say transgender pipo wit gender recognition certificate (GRC) dey entitled to sex-based protections, while For Women Scotland argue say e only dey apply to pipo wey dem born as female.

Di ruling, wey dem wan announce at 09:45, go set out how di law go treat transgender pipo.

E fit affect single-sex spaces and services, as well as equal pay claims, maternity policy and sports events.

Di legal arguments come at di time of heated debate on gender issues.

Di Supreme Court wan decide on di proper interpretation of di 2010 Equality Act, wey dey applied across Britain.

Di law provide protection against discrimination on di basis of various characteristics, including "sex" and "gender reassignment".

Scottish trans charity urge pipo make dem no panic

Edinburgh-based trans rights charity Scottish Trans don urge pipo say make dem no panic sake of di ruling.

"Lots of commentary go come out quickly wey dey likely to deliberately overstate di impact wey dis decision go get on trans pipo lives," di charity write on social media platform Bluesky.

"We go say more as soon as we dey able to. Please look out for yoursefs and each oda today," di statement add.

Judges for London dey rule on wetin di law mean by "sex" - weda e mean biological sex, or legal, "certificated" sex as defined by di 2004 Gender Recognition Act.

Di Scottish goment tok say di 2004 legislation dey clear dat obtaining GRC amounts to change of sex "for all purposes".

Goment lawyer Ruth Crawford KC tell di court say "pesin wey don become di sex of dis acquired gender dey entitled to di protections of di sex".

Aidan O'Neill KC, wey dey represent For Women Scotland, argue say for "common sense" meaning of di words man and woman, e tell di court say sex na "immutable biological state".

How we take get here?

Di legal dispute begin for 2018, wen di Scottish Parliament pass one bill design to ensure gender balance on public sector boards.

For Women Scotland complain say ministers don include transgender pipo as part of di quotas in dat law.

Afta several cases in di Scottish courts, dem don send di issue to di Supreme Court in London for final ruling.

For Women Scotland don warn say if di court side wit di goment,e go get implications for di running of single-sex spaces and services, such as hospital wards, prisons, refuges and support groups.

Transgender pipo don warn say di case fit erode di protections wey dem get against discrimination for dia reassigned gender.

Amnesty International tok say since di Equality Act protect oda minority groups, di case fit be di "thin end of di wedge" wey fit undermine oda rights.

Di Equality and Human Rights Commission - di regulator in charge of enforcing di 2010 act - don call for legal reform as result of di case.

Di Scottish Parliament don pass reforms in 2022 wey go make am easier for someone to change dia legally recognised sex.

Na move block by di UK goment, and Holyrood ministers don drop am since.

Source: BBC