Menu

South African farm worker tok how dem force am to feed pigs wit dead women body

Screenshot 2025 08 04 151914.png Adrian de Wet (L) go take di stand against im boss Zachariah Johannes Olivier (R)

Mon, 4 Aug 2025 Source: BBC

One white South African farm worker wey dey face accuse of killing two black women say im bin dey forced to feed pigs dia deadi body, according to lawyers.

Adrian de Wet na one of three men wey dey face murder charges afta Maria Makgato, 45, and Lucia Ndlovu, 34, die as dem allegedly bin dey look for food for one farm near Polokwane for South Africa northern Limpopo province last year.

Dem allegedly give pigs dia deadi body so dem fit hide di evidence.

Oga De Wet, 20, wey be state witness wen di trial start on Monday say di owner of di farm Zachariah Johannes Olivier shot and kill di two women.

Madam Makgato and Madam Ndlovu bin dey search for dairy product wey go soon expire wey dem dey leave for pigs wen dem kill dem.

Oga De Wet,one supervisor for di farm, testify say im bin under duress wen im bin dey forced to throw deadi bodies inside pig cage, according to both di prosecution and im lawyer.

If di court accept im testimony, dem go drop all charges against am.

Di case dey make pipo vex across South Africa, e don make di racial tensions for di kontri worse.

Dis tension especially for rural areas plenty, despite di end of di racist system of apartheid more than 30 years ago. Most private farmland dey owned by white minority, while most farm workers dey black and dey poorly paid, all dis issues dey fuel resentment among diblack population, while many white farmers complain of high crime rates.

William Musora, 50, anoda farm worker, na di third accused. Him and Oga Olivier, 60, still neva enta a plea and dem still dey prison afta dia bail applications fail.

Di three men also dey face charges of attempted murder for shooting Madam Ndlovu husband, who bin dey wit di women for di farm - as well as possession of an unlicensed firearm and defeating di ends of justice.

Oga Musora, one man from Zimbabwe dey face an additional charge under South Africa Immigration Act sake of im status as an illegal immigrant.

Di Limpopo High Court bin full wit supporters and relatives of di victims ahead of proceedings.

Members of opposition party Economic Freedom Fighters, wey bin don tok bifor make authorities close di famr, all of dem bin dey present inside di courtroom.

Dem don postpone di trial to next week.

Source: BBC