Menu

Malawi President Chakwera concede defeat for ongoing presidential election

Lazarus Chakwera 5846.png Malawi President Lazarus Chakwera

Wed, 24 Sep 2025 Source: BBC

Malawi President Lazarus Chakwera don concede defeat for di presidential election wey dem neva announce di result.

E announce im concession for a nationwide address wey e do on Wednesday ahead of di declaration of di results.

Chakwera bin concede defeat to Arthur Peter Mutharika of di Democratic Progressive Party.

For im live speech to di nation few moments ago, Mr Chakwera congratulate im opponent Mutharika.

"From dose official results e dey clear say my main rival, Professor Mutharika, don alreadi secure surmountable lead."

"For dis reason, moment ago, I call Professor Mutharika to congratulate am for dis historic win".

E also confam say e approach di courts yesterday to try and stop dem make dem no announce di results but e say im accept di court ruling say di electoral commission gatz go ahead and announce di results.

Chakwe also say "Malawians, weda you' dey di losing or winning side, please remain peaceful".

Wit dis latest info, di Malawi Electoral Commission dey expected to declare results of di presidential election at 1300bst.

Bifor now, Malawi former President Mutharika don take comfortable lead for di kontri presidential race, as two-thirds of districts don report provisional results.

Di 85-year-old bin receive around 66% of di valid votes wey dem don count so far, and im closest rival, di incumbent Lazarus Chakwera, wey be 70-year-old bin get around 24%.

Profile of Peter Mutharika of di Democratic Progressive Party (DPP)

Mutharika, na 85-year-old former lawyer and law lecturer. E lead Malawi from 2014 to 2020.

E be di brother of late President Bingu wa Mutharika, wey die for office for 2012.

Like Chakwera, Mutharika also chop accuse of corruption allegations plus e dey linked to economic crises.

However, im supporters go argue say di current high inflation rate (around 27%) na proof say Mutharika manage di economy well pass im successor.

Mutharika age fit work against am for dis election - speculation about im health also dey ground, especially as pipo no too see am for public during di campaign period.

Source: BBC