White House physician say US President Donald Trump still dey in "excellent overall health" aft im undergo comprehensive executive physical session.
Captain Sean Barbabella release memo on Monday say advanced imaging wey di 79-year-old president do show say im heart and abdomen dey "perfectly normal".
E write say di president undergo MRI during one physical screening for October unto say "men wey dey im age group dey benefit from thorough evaluation of cardiovascular and abdominal health".
Di release dey come as Democrats including govnor Tim Walz of Minnesota don dey push for di result of di scan sake of concerns about Trump age for im second term.
For im memo, Barbabella write say no evidence of arterial narrowing dey wey fit stop blood flow or abnormality for Trump heart or major vessels.
Di doctor say Trump cardiovascular system show "excellent health".
Also, di doctor wey be US Navy emergency physician wey don serve for Iraq and Afghanistan say results of Trump imaging show say "evritin wey dem evaluate dey function within normal limits wit no acute or chronic concerns".
Di doctor call di scan "standard" for "executive physical" for somebodi wey dey Trump age.
White House bin no gree explain why Trump do MRI during physical exam for October or say which part of di body dem scan.
For inside Air Force One on Sunday Trump tell reporters say e dey okay for am to release di result of di MRI.
Wen one reporter ask am which part of di body di MRI examine, Trump say "I no get idea, na just MRI - which part of di body? No be my brain, unto say I do cognitive test and I pass."
Trump do im annual physical screening for April.
For October, e say im do MRI for Walter Reed National Military Medical Center during during one visit to White House say na routine yearly check up.
Dat time Trump say di MRI dey perfect.
For di memo, Barbabella say di purpose of di MRI na to dey preventive "to identify issues early, confirm overall health and ensure im dey maintain long term vitality and function".
White House press secretary Karoline Leavitt read Barbabella memo during news briefing on Monday.
"I think dat na bit of detail just to show transparency" na so Leavitt tok. "Di president promise am last night and we don deliver today."
Two outside physicians wey review di memo tell BBC say di MRI "no dey typically standard" for preventative care.
But some pipo dey opt for testing, dis na standard age based guideline na so Dr Carla Perissinotto tok. Im be geriatric specialist for University of California San Francisco.
Likewise, Dr Jeffrey A. Linder wey be chief of general internal medicine for Northwestern University Feinberg School of Medicine say di memo no tok weda na MRI or CT scan dem do, say dis make difficult for pesin to know wetin dem do.
Linder say routine anatomical imaging - weda MRI or CT scan dem - dey generally discouraged for asymptomatic patients unto say di potential risks big pass di benefits.
And even for executive physical wey be for busy professionals and include additional tests - e say e dey uncommon for dat imaging to come back "perfectly normal" wit no coronary calcification.
Pipo don see Trump wit swollen ankles and bruise on him right hand and sometimes dey sleep during meetings.
For July, di White House say dem diagnose him of chronic venous insufficiency, vein condition wey fit cause swelling for di legs.