Menu

Trump go host di signing of peace deal between leaders of DR Congo and Rwanda

KHVN,VB.png DR Congo President Felix Tshisekedi (L), Donald Trump(M) and Rwandan President Paul Kagame

Thu, 4 Dec 2025 Source: BBC

Leaders of di Democratic Republic of Congo and Rwanda don ready to sign one peace deal wey go end di long-running conflict for di region for one summit wey US President Donald Trump dey host for Washington.

Bifor di summit, serious fights bin don happun for di resource-rich eastern DR Congo between govment forces and rebels wey pipo believe say get di support of Rwanda.

DR Congo army bin accuse dia rivals say dem try to "sabotage" di peace process, but di M23 rebels tok say di army launch one attack wey breach one ceasefire operation.

For di beginning of di year, M23 bin seize large parts of eastern DR Congo for inside one attack wey lead to di death of thousands of pipo and force many pipo to run comot dia house.

For di beginning of di year, M23 bin seize large parts of eastern DR Congo for inside one attack wey lead to di death of thousands of pipo and force many pipo to run comot dia house.

DR Congo President Felix Tshisekedi plus im Rwandan counterpart Paul Kagame don often exchange insults in recent years, dem accuse each oda of starting di conflict.

Trump bin make di two countries' foreign ministers sign one peace accord for June, wey e hail as a "glorious triumph".

Tshisekedi and Kagame go now endorse am. Several oda African and Arab leaders – wey include dos of Burundi and Qatar – dey expected to attend di signing ceremony.

Di M23 no go dey present - dem dey in talks wit DR Congo govment for inside one parallel peace process wey Qatar dey lead.

Di Trump administration shoulder di talks between DR Congo and Rwanda, wit hope say settling di differences between di two neighbours go pave way for di US to increase investments for di resource-rich region.

Rwanda deny say dem support M23, despite wetin UN experts tok say, dia army dey for "de facto control of M23 operations".

Di M23 seize key cities for eastern DR Congo earlier dis year, wey include Goma and Bukavu.

For one statement, DR Congo army tok-tok pesin, Gen Sylvain Ekenge say di rebels bin launc one fresh attack on Tuesday for villages wey dey di South Kivu province.

Di villages dey about 75km (47 miles) from Uvira city, e lie for di border wit Burundi, and e don bicom di headquarters of di South Kivu regional govment since di rebels seize Bukavu.

For dia part, di M23 tok say na di DR Congo army bin launch one air and ground assault against dia positions, and dem do am in collaboration wit Burundian forces.

Burundi neva comment on dis allegation. Dem get plenty thousand troops for eastern DR Congo to support di embattled army.

Despite di fanfare plus di presence of di two leaders for Washington, some analysts are sceptical about whether the deal will lead to lasting peace.

A DR Congo researcher with the South Africa-based Institute for Security Studies think-tank, Bram Verelst, told the BBC that there was "currently no ceasefire in place, and the M23 rebellion continues to expand and consolidate its control".

"The signing ceremony is unlikely to alter this situation, though there is some small hope it could increase accountability on Congolese and Rwandan leaders to honour their commitments," he said.

Rwanda says it has adopted "defensive measures" in eastern DR Congo because of the threat posed by the FDLR militia group, which includes fighters who carried out the 1994 Rwandan genocide.

Kagame insists on the disarmament of the group, while DR Congo demands the withdrawal of Rwandan troops as a condition for peace.

The deal to be signed says both of these should happen.

However, plenty peace deals wey go back to di 1990s don fail afta Rwanda accuse previous Congolese govment say dem fail to disarm di FDLR and dis na still one of di main stumbling blocks for inside current efforts to end the conflict.

DR Congo also dey demand say make di M23 release di territory dem seize, something wey so far don refuse to do for di Qatar-brokered talks.

Qatar and di US dey co-ordinate dia mediation efforts. Qatar get strong ties wit Rwanda, while e be like say di US dey closer to DR Congo.

Di US State Department for 2023 tok say DR Congo get estimated $25trn (£21.2trn) in mineral reserves.

Dis include cobalt, copper, lithium, manganese and tantalum - key ingredients wey dey needed to make di electronic components dem dey use for computers, electric vehicles, mobile phones, wind turbines and military hardware.

"We dey get, for di United States, plenty of di mineral rights from di Congo as part of am," Trump tok, ahead of di deal dem sign for June.

Prof Jason Stearns, one Canada-based political scientist wey specialise for di region, tell BBC say US for long don dey push for one economic agreement wey fit see DR Congo and Rwanda co-operate on hydro-electronic power, mining and infrastructure development.

"Di logic na say dem go provide di peace dividend," e tok.

However, DR Congo don make am clear say even if dem sign di agreement, dem no go "advance on dat deal until Rwandan troops don withdraw from eastern DR Congo", Prof Stearns added.

Source: BBC