Attack by some unknown bandits don make thousands of pipo run commot from dia homes
Tori from Sokoto state for north west Nigeria say attack by some unknown bandits don make thousands of pipo run commot from dia homes for Tidibale ward inside Isa Local Govment Area of di state, victims confam.
One video wey BBC News Pidgin see for Bakatsine X page show plenty pipo wey dey find safe zone for one place wey look like school.
Pipo wey dey live for Tidibale confam di matter to BBC News Pidgin say as e be now, nobody remain for di town of Tidibale.
Dem add say di constant killing and kidnapping wey bandits dey do anytime dem attack na di main reason why thousands of pipo comot leave the town to save dia lives.
One resident wey get im freedom recently from bandits hand afta dem pay two million naira ransom tok say for now, pipo from di town don scatter go oda places to survive.
"Na while I still dey for dia hand dem tell me say dem don scatter our town, nobodi dey again, and dem also tell me say dem shoot my papa, and now I dey treat am for hospital," im tok.
"Na last week dem kidnap me for front of my house afta I return from Shinkafi Local Govment Area of Zamfara state. I spend about seven days for dia hand and na afta dem pay two million naira bifor dem release me."
E describe staying wit bandits as di most terrible experience of im life.
"To stay for bandits hand pass any wahala for dis world, bicos even prisoner dey enjoy pass you," im tok.
Im papa wey dey hospital tell BBC say for now dem dey live inside fear because dem don run commot from dia town and wia dem run go, dem no even get where to sleep.
"We dey sit down for night dey eat wen we hear dem enter. As I comot from house to run, dem shoot me for chest. Now I dey hospital dey treat myself, sake of say my time to die never reach," im tok.
"Right now pipo of Tidibale dey suffer bicos many don run go oda towns to look for shelter."
E add say four small children dey sick now because dem no get good place to sleep.
"Di biggest problem now be say we no even get wia to sleep, and our children dey fall sick because dem no get good sleeping place."
Wen BBC ask am whether dem report their situation to security agencies, e answer say:
"Security agencies know wetin dey happun bicos even now na dem dey escort our pipo go Tidibale town to collect dia properties wey dem leave behind wen dem run."
Residents of di town don beg govment and security agencies make dem help and come rescue dem for their town, because there is no place like home.
BBC News Pidgin contact di tok-tok pesin for Sokoto Police Command, Rufa'i Ahmad, wey tok say for now dem dey investigate di authenticity of di video wey dem see for social media so dem go take di right action.
On 25 December US President Donald Trump say dem launch a "powerful and deadly strike" against di Islamic State for Nigeria.
For post ontop im Truth Social account, Trump say: "under my direction as Commander in Chief, di United States launch a powerful and deadly strike against ISIS terrorist Scum for north west Nigeria , wey don dey target and viciously kill primarily, Innocent Christians at levels wey dem never see for may years".
Nigeria Ministry of Foreign Affairs wey also confam di strikes say dem collaborate wit America to carry am out.
For statement ontop dia X account, di ministry say Nigeria dey cooperate wit international partners including America to address di threat of terrorism and violent extremism.
Dem say di collabo lead to "precision hits on terrorist targets for Nigeria and by air strikes for di north west.