Menu

Ghana rate higher, Nigeria drop for international passport rating

Ghana Passport Ghana Passport Ghana Passport Sombody dey hold Ghana passport

Thu, 15 Jan 2026 Source: BBC

Nigeria passport don move down one point in less dan one year to di 89th oposition for di latest Henley Passport Index for 2026.

According to di Index, Nigeria passport fit enta 44 kontris visa-free. Dis na drop on one position and one kontri less dan di index update wey drop for 2025.

Ghana rate higher for 69th position wit access to 68 kontris, while Cameroon dey for 87th position wit access wit 47 kontris.

Di index use di data by di International Air Transport Association (IATA) to rank 199 passports based on dia strength to travel.

Dat na how many kontris out of di 227 travel destinations wey dey wey pesin wit one of di passport fit enta without visa.

Passports na travel document wey dey grant access for citizens across di world.

Na Singapore hold di record for di most powerful passport, wit access to 192 nations, while Afghanistan rank di weakest passport globally wit access to only 24 kontris.

Di top eight kontris globally na Singapore, Japan, South Korea, Denmark, Luxembourg, Spain, Sweden, and Switzerland.

Dis na di kontris wey dey for di top three positions for index.

Singapore come first wit 192 kontris; Japan and South Korea dey joint second wit access to 188 kontris. Meanwhile for third position na Denmark, Luxembourg, Spain, Sweden and Switzerland wit access to 186 kontris.

Seychelles maintain dia top sport for African kontris for di 24th position wit access to 154 kontris. Dis na drp of access to two kontris from 2025.

Kontris wit di strongest passports in di world

From first to 10th position for di list of kontris for di index include:

.1st position - Singapore wit access to 192 kontris

.2nd position - Japan and South Korea wit access to 188 kontris

.3rd position - Denmark, Luxembourg, Spain, Sweden and Switzerland wit access to 186 kontris

.4th position - Austria, Belgium, Finland, France, Germany, Greece, Ireland, Italy, Netherlands and Norway wit access to 185 kontris

.5th position - Hungary, Portugal, Slovakia, Slovenia and United Arab Emirates wit access to 184 kontris

.6th position - Croatia, Czechia, Estonia, Malta, New Zealand and Polant get access to 183 kontris

.7th position - Australia, Latvia, Liechtenstein, and United Kingdom get access to 182 kontris

.8th position - Canada, Iceland and Lithuania get access to 181 kontris

.9th position - Malaysia get access to 180 kontris

.10th position - United States get access to 179 kontris

Kontris wit di weakest passports in di world

Some of di kontris wey get di weakest passports for work include

Some of di kontris wey get di weakest passports for work include

.91st position - South Sudan and Sudan get access to 41 kontris

.92nd position - Iran get access to di 40 kontris

.93rd position - Libya and Sri Lanka get access to 39 kontris

.94th position - Eritrea, North Korea and Palestine Territory get access to 38 kontris

.95th position - Bangladesh get access to 37 kontris

.96th position - Nepal get access to 35 kontris

.97th position - Somalia get access to 33 kontris

.98th position - Pakistan and Yemen get access to 31 kontris

.99th position - Iraq get access to 29 kontris

.100th position - Syria get access to 26 kontris

.101st position - Afghanistan get access to 24 kontris

Wetin be di strongest and weakest African kontris

Di strongest African passports include:

.Seychelles - dey 24th position wit access to 154 kontris

.South Africa - dey 48th position wit access to 101 kontris

.Botswana - dey 59th position wit access to 81 kontris

.Namibia - dey 62nd position wit access to 76 kontris

.Lesotho - dey 63rd position wit access to 74 kontris

.Morocco and eSwatini - dey 65th position wit access to 72 kontris

.Malawi - dey 66th position wit access to 71 kontris

.Kenya and The Gambia - dey 68th position wit access to 69 kontris

.Ghana and Tanzania - dey 69th position wit access to 68 kontris

.Benin, Rwanda and Tunisia - dey 70th position wit access to 67 kontris

Di weakest African kontris na:

.Egypt - dey 85th position wit access to 50 kontris

.Angola, Burundi, Central African Republic, and Liberia - dey 86th position wit access to 49 kontris

.Cameroon, and Repuublic of Congo - dey 87th position wit access to 47 kontris

.Djibouti - dey 88th position wit access to 46 kontris

.Nigeria - dey 89th postion wit access to 44 kontris

.D.R Congo and Ethiopia - dey 90th position wit access to 43 kontris

.South Sudan and Sudan - dey 91st position wit access to 41 kontris

.Libya - dey 93rd position wit access to 39 kontris

.Eritrea - dey 94th position wit access to 38 kontris

.Somalia - dey 97th position wit access to 33 kontris

l>

Source: BBC