Menu

Ogbonge Indian politician Ajit Pawar die for plane crash

Ajit Pawar.png Ajit Pawar, deputy chief minister of India western state of Maharashtra, don die

Wed, 28 Jan 2026 Source: BBC

Ajit Pawar, deputy chief minister of India western state of Maharashtra, don die for plane crash along wit four other pipo.

Di cause of di crash neva dey officially confirmed.

Pawar political career span decades and e serve as di deputy chief minister of Maharashtra several times.

Prime Minister Narendra Modi dey among dose wey don express shock and grief at di news of the crash

Maharashtra to observe three days of mourning



Pawar home state Maharashtra don declare three days of official mourning following di tragic death in plane crash earlier today.

During dis period, flags across di state go fly at half‑mast and govment offices and schools go remain shut. Officials say all public events don dey cancelled as mark of respect.

Di mourning period reflect di state recognition of im long service and influence for di state politics.

Who be Ajit Pawar?

Pawar, wey be nephew of ogbonge politician Sharad Pawar wey establish di Nationalist Congress Party (NCP), na influential politician for Maharashtra.

Im political career last many years and e don serve as deputy chief minister of Maharashtra several times.

Few years ago, e break away from im uncle party wit some lawmakers and form im own party, wey India Election Commission later officially recognise as NCP.

Source: BBC