Nigeria dey rank low pass several African kontris for di Corruption Perceptions Index 2025
Nigeria dey rank low pass several African kontris for di Corruption Perceptions Index (CPI) 2025 ranking wey dem just release.
For di ranking, na about 182 kontris take part and wia 122 kontris score below 50.
According to Transparency International, di organisation wey dey incharge of di ranking, na only five kontris score above 80 out of 100 score.
Kontris for Africa bin also follow for di ranking, wia Cape Verde or Cabo Verde wit 62 score na di highest ranked African kontris for 35th position.
Botswana and Rwanda follow for 41st position wit 58 score while some oda African economies score low.
Nigeria dey for di 142 position wit 26 score out of 100, Niger dey 124 position wit 31 score, Kenya dey 130 position wit 30 score, Burkina Faso dey 84 position wit 40 score.
According to di ranking 100 score na di highest and e mean veri clean while 0 score mean highly corrupt.
Full list of all di kontris for di corruption index, dia score and rank bin dey below dis story.
Di organisation say make leaders bin make political finance transparent and protect media freedom.
Di Transparency International 2025 Corruption Perceptions Index dey measure levels of public-sector corruption in 182 countries.
For di 2025 ranking, di number of countries wey score above 80 bin reduce from 12 go five wit di worry say countries of democracies dey witness corruption.
According to di CPI, dem say corruption remain serious threat for evri part of di world.
Part of di reason wey dem give na abuse of power, attacks on independent civil society including di anti-govment protests for many parts of di wey dey show say pipo don taya for bad leadership.