Foreign Affairs Minister Ablakwa confam di appointment of Baba Sadiq
Ghana President John Dramani Mahama don appoint media entrepreneur and political strategist Baba Sadiq Abdulai Abu as High Commissioner designate to Nigeria.
Di appointment of di 40-year-old dey come weeks afta di president withdraw Baba Jamal wey be di high commissioner at di time, sake of im abandon im post to pursue anoda political role for Ghana.
Foreign Affairs Minister Samuel Okudzeto Ablakwa confam di appointment.
"Congratulations oga Baba Sadiq on your well-deserve appointment by President Mahama as High Commissioner designate to di Federal Republic of Nigeria," di minister write on top im social media.
Im add say, "I get no doubt for mind say you go carry di Ghana flag high and make di youth of Africa proud."
Di 40-year-old react to di appointment say, "I don make honoured by di confidence wey di president get for me wey e appoint me for dis post."
"I also appreciate di foreign affairs minister well well for di support."
Baba Sadiq now assure im followers and di presidency say "I dey committed to serve Ghana wit diligence and integrity."
Wetin hapun bifor di high commissioner post become vacant?
Baba Jamal wey be di past high commissioner decide say im wan become parliamentarian to replace di member of parliament for Ayawaso East – Naser Toure Mahama wey die early dis year on di ticket of di govment party.
Pipo bin accuse am say im be greedy politician as im get one post as diplomat but im still wan become member of parliament.
But oga Jamal respond to di critics; im tok say im decide to leave di high commission to become MP sake of im wan "serve di pipo well as dia rep."
Im also tok say im dey get plenty money as diplomat but im decide to return to Ghana to fight for anoda position – meaning say no be money he dey pursue.
Na so im leave di high commission for Abuja to campaign for di party primaries in Ghana; Baba Jamal win dat contest by 32 votes.
But im chop accuse say im use cash, TV set, motorbike, foodstuff and oda tins to buy votes for di constituency.
Na so di National democratic congress (NDC) decide to investigate di allegation – wey president Mahama also recall am from his post as high commissioner.
Even though di party confam say Baba Jamal engage for vote-buying, dem tok say no be only im do dat tin.
Di oda candidates also bin buy vote for dat Ayawaso East election – so dem decide say dem no go cancel di election result, as many pipo and experts togeda wit di majority caucus for parliament bin call for.
Now Baba Jamal dey set to become di MP for di constituency for dia by-election wey dey hapun on 3 March.
According to multiple polls, di 56-year-old lawyer be favourite to win di by-election for di govment party stronghold – even though di opposition new patriotic party (NPP) also dey contest for di vote.
President Mahama now decide to appoint Baba Sadiq to become high commissioner to Nigeria.
Profile of Baba Sadiq Abdulai Abu; High commissioner designate
Many pipo for Ghana sabi Baba Sadiq for di entertainment and creative art industry, sake of im be founder of 3 media network limited – owners of 3Music TV and producers of 3Music awards.
Bifor im decide to create im own media company, Baba Sadiq bin work for many years for di industry for different places – like Hitz FM, Muse Africa, Transsnet music limited, Rave group among odas.
As a young pesin, Baba Sadiq use im platform to promote musicians and oda creative talents bifor im decide to enta politics.
Im dey involved for di govment party dia manifesto drafting process bifor di 2020 elections; especially di part of di manifesto wey concern arts, tourism and creative arts.
Baba Sadiq now decide to contest for parliamentary election for di Okaikwei Central constituency for Accra in 2024.
E lose dat election to di current MP for di area Patrick Boamah by about 1730 votes.
One year afta im lose dat election, president Mahama don give am appointment; sometin wey make di entertainment and art industry pipo happy well well.
Apart from im media and entertainment industry experience, Baba Sadiq be marketing and communication expert.
Im also get skills for business management, govment and public affairs, commercial diplomacy, trade and investment promotion among odas.
Plenty musicians and industry pipo don begin dey shower am wit praise and goodwill since di announcement.
Rapper Sarkodie describe di appointment as "fantastic," wey dancehall artiste Shatta Wale write say "congratulations to my boss, my business tutor and mentor to many."
Popular Youtuber and travel blogger Wodemaya, sports journalist Gary Al-Smith and many odas carry dia social media to congratulate am.
Baba Sadiq dey enta Nigeria for dis post as high commissioner five months afta President Mahama bin swear-in di past commissioner – Baba Jamal.
Im dey expected to strengthen di bond of friendship, cooperation and relations between Ghana and Nigeria.
Baba Sadiq go provide leadership for bilateral engagement for areas like trade, investment, culture, tourism, entertainment, peace and security, afta di president swear am in and formally give am di mandate.
Di president appoint di 40-year-old media entrepreneur to replace Baba Jamal wey decide to return to Ghana to pursue a parliamentary agenda
Baba Jamal (L) say im decide to leave Abuja to enta parliament "to serve im constituents" wey im be favourite to win the by-election for Ayawaso on 3 March
Im dey expected to strengthen di bond of friendship, cooperation, and relations between Ghana and Nigeria