Donald Trump don warn say "whole civilisation go die tonight" unless Iran make deal on reopening di Strait of Hormuz.
But di US president add say "somtin revolutionarily wonderful fit happun" bifor im deadline of 20:00 on Tuesday (EDT) for Iran to reopen di key shipping channel.
Meanwhile di US don carry out new strikes on military targets on Kharg Island, Iran key oil export terminal.
Israel warn Iranians say make dem no travel by train - and say e dey "endanger your life" - and also confam one attack one third petrochemical site
Di number of pipo wey don kpai for Iran since di US-Israeli attacks begin don pass 3,500, including at least 1,665 civilians, one US-based human rights group tok.
Meanwhile, Iran say dem don formally reject one US ceasefire proposal, state media report - while sharing one list of demands.