De management for Christian Atsu say de search for de player still dey go on, nine days afta de earthquake for Turkey.
According to en agent, Nana Sechere, dem locate Christian Atsu en exact room location where dem find two pairs of en shoes.
"E don reach nine days since di earthquake and we still never locate Christian," Sechere tweet on Tuesday.
“We manage locate Christian Atsu en exact room location, wey we find two pairs of en shoes” Nana Sechere talk.
“Yesterday, we receive confirmation say thermal imagery dey show signs of up to five lives, but dem say de only real confirmation of life be through sight, smell den sound wey unfortunately we no locate Christian” he add.
Atsu en agent say he currently dey de search grounds but things dey move slow so de rescue process dey delay, wey people dey lose dia lives sake of de lack of resources.
“Dis be difficult situation, but we be grateful to all de Turkish and foreign rescue teams, local civilians and volunteers for dia efforts and response in rescuing survivors. But we dey need more resources urgently, including translator, on de ground” Nana Sechere add in de statement.
His club Hatayspor initially reported he was rescued "with injuries" but a day later that position changed.
Christian Atsu agent bin reveal say de footballer whereabouts still dey unknown afta initial reports say dem pull am out from de wreckage "wit injuries" afta de Turkey earthquakes.
Dem still dey rescue some survivors afta di quakes and aftershocks for southern Turkey and northern Syria wey don kill more dan 40,000 pipo as at di time of dis report.
It has been 9 days since the earthquake and we still have not located Christian.
I am at the quake site in Hatay with Christian’s family. The scenes are unimaginable and our hearts are broken for all the people affected.
— Nana Sechere (@iAmNana7) February 14, 2023
Christian Atsu be Ghanaian international player who dey play professional football in de Turkish Super League.
Born 10 January 1992, Ghanaian professional footballer dey currently play for Hatayspor.
He start en career for Porto, wey he later spend one season on loan for Rio Ave.
In 2013, Chelsea sign am for £3.5 million wey dem loan am to Vitesse Arnhem, Everton, AFC Bournemouth den Málaga.
After spending de 2016–17 season on loan for Newcastle United, he complete en permanent transfer to de club in May 2017.
As an international player he play over 30 caps since he join Black Stars in 2012.
Atsu represent Ghana for de 2014 FIFA World Cup and two Africa Cup of Nations tournaments.
He helped de team finish as runners-up for de 2015 Africa Cup of Nations where he win Player of the Tournament and Goal of de Tournament awards.