Menu

Cameroon sack coach, drop Onana from Afcon 2025 squad weeks to Caf tournament

Andre Onana.png Andre Onana dey on loan for Turkish side Trabzonspor from Manchester United

Tue, 2 Dec 2025 Source: BBC

Andre Onana no dey Cameroon squad for Africa Cup of Nations (Afcon).

Dis na as di team dey inside serious wahala afta head coach Marc Brys chop sack bcos of allegation of "trick".

Just few days afta dem re-elect Samuel Eto'o as Cameroonian Football Federation (Fecafoot) president, Eto'o and im executive committee announce Brys sack for one dramatic statement.

Di statement carry long list of accusation of "professional failure" wey dem throw give Brys, include say e dey "incite" players make dem disobey Fecafoot.

Di Belgian wey Cameroon sports ministry bin appoint for April 2024, decision wey Eto'o try reverse sharp sharp dem also accuse am say e dey "actively collaborate wit unknown individuals inside Fecafoot".

Dem also accuse am say e no dey attend meetings, e refuse show im training programme, e dey put relationship wit sponsors for risk, e no dey release squad list on time and e dey use "trick to escape im professional obligation to hold press conferences".

Brys don get replacement wit one of im assistants, David Pagou, one experienced Cameroonian coach wey don manage plenti teams for di kontri top league.

But Pagou 28-man squad for di Afcon wey go happun for Morocco, wey go start 21 December, miss some important players.

Players wey no dey include goalkeeper Onana, team captain Vincent Aboubakar, Napoli midfielder Andre-Frank Zambo Anguissa and defender Michael Ngadeu.

Even though Anguissa don injure, dem neva give any reason for di oda players wey dem leave out.

Coaching changes kontinu under Eto'o

Since Brys come, Fecafoot and Cameroon sports ministry don dey drag each oda sake of whether di 63-year-old contract dey legal and legit.

But no be di first manager wey Eto'o regime don sack.

Afta dem first elect am as Fecafoot oga for December 2021, di former Barcelona and Inter Milan striker quick quick oversee di sack of Portuguese coach Toni Concecaio, wey carry Cameroon finish third for home ground for 2021 Afcon, even as ministry oppose di decision.

Anoda Cameroon legend, Rigobert Song, dem appoint am immediately to replace Conceicao under instruction from di kontri President Paul Biya.

Rumour strong say na also Eto'o pick am, Song lead Cameroon go 2022 World Cup for Qatar wey Onana comot early afta suspension from Fecafoot but poor performance for di last Afcon for Ivory Coast end di former West Ham and Liverpool defender time as head coach.

Sports ministry own choice of Brys to replace Song shock Fecafoot well well.

Less dan two months later, dem remove di Belgian afta hot quarrel wit Eto'o but dem bring am back two days later as di federation president apologise.

Since Brys no fit qualify di team for next year World Cup, afta loss to Dr Congo for African play-offs, e be like say Eto'o don finally get wetin e wan.

But we never sabi whether di ministry, wey dey pay head coach salary, go gree to Fecafoot and Eto'o dis time. BBC hear say for now, dem no get anytin to tok.

"E go hard for new manager to fit arrange playing system, create chance wey go make players express demselves well for pitch and play like one unit," Cameroonian analyst Njie Enow tell BBC Sport Africa.

Anytin wey happun for pitch, Fecafoot allegation of misconduct and di sack of Brys just few weeks befor big tournament na just di latest drama under Eto'o leadership, wey don full wit different scandals and opposition from local football stakeholders.

Onana international career over?

Onana, wey get 59 caps, na di biggest name wey dem remove from Cameroon Afcon squad.

But e no too surprise sake of di form wey e show for Manchester United bifor dem loan am go Turkish side Trabzonspor for September, plus wetin happun to am for recent big tournaments.

No be only say dem send am go house early for Qatar 2022, e still lose im position as first-choice goalkeeper for 2023 Afcon afta e delay come di tournament bicos e wan play one extra match for United.

Afta dem no put am for Indomitable Lions first group match against Guinea bicos of dat one, e return for di 3-1 loss to Senegal match wey pipo fit tok say e cause di first goal.

Fabrice Ondoa come dey preferred for di match wey dem beat Di Gambia and di loss to Nigeria for round of 16.

Onana move go Trabzonspor come make am regain im number one position under Brys, and e start di World Cup play-off loss to DR Congo last month.

But since Brys don comot, no space for di 29-year-old for squad wey carry four goalkeepers.

Onana Manchester United teammate Bryan Mbeumo dey included, same wit Brighton midfielder Carlos Baleba.

But Indomitable Lions go seriously miss di experience of Serie A winner Anguissa, wey injure hamstring last month and choose to focus on im recovery for Napoli.

Witout some of dia experienced stars, Cameroon get tough group to survive for Morocco.

Dem go face defending champions Ivory Coast, Pierre-Emerick Aubameyang Gabon and Mozambique for Group F.

Source: BBC