BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

'Dem dey kidnap us evriday' - Victims of attack for Federal University of Lafia tok wetin dia eyes dey see

54055644 File foto

Thu, 7 Dec 2023 Source: BBC

Victims of kidnapping wey dey stay for Gandu community, home of di Federal University of Lafia, (FULAFIA) say di tin wey dia eyes don see no be small.

Dis na afta tori break on Thursday morning about how jaguda pipo go kidnap some students of di university wey dey stay for Gandu community on Wednesday night, 6 December, 2023.

One of di victims, Daniel Ebuga, wey be third-year student narrate to BBC Pidgin di trauma wey im pass thru months ago wen dem kidnap am.

Im say "na evriday dem dey kidnap pipo witout any fear" di students and pipo wey dey stay for di community don dey endure painful ordeal as jaguda pipo still dey continue to kidnap dem.

"Di police no dey help us, di criminals dey come raid evritime especially on Mondays. Dem don make life for campus dey full of constant fear. How we wan take write exams wit dis fear?" E tok

Another student say di recent incident wey happun wia dem kidnap a group of students wey dey stay inside one lodge named Confidence be victims, and na only few pipo manage to escape.

Di student accuse police of extortion. Dem say police dey collect moni from dem but no dey give dem beta security.

"We want police again, we want di military to help us," she tok

Di students tell BBC Pidgin say dem no dey fit sleep peacefully again. Dem dey request for security post wey di military go man, and na di only way dem go get beta solution to dia security palava.

'One pesin die for di attack' - Police tok

Meanwhile di state police tok-tok pesin, DSP Rahman Nansel, wey confam di tori of di kidnap and death of di mechanic for telephone interview say: "One person die for di attack while di criminals kidnap di wife and daughter of di deceased.

Im say wen di police command receive di distress call serious shooting bin dey happun around di Gandu area by gunmen, so dem draft dia men to di scene of di incident.

Im add say wen officers arrive di scene dem discover say di gunmen don already shoot one Danteni wey be mechanic and im die for hospital.

“Our personnel of di command go back wit a re-enforcement team to protect di entire Gandu community but before dem go reach di house of di deceased, di gunmen don carry im wife comot.

“Our personnel comb di entire area but all efforts to rescue di woman proved abortive,” im add.

Di community district head, Abdullahi Mohammed say di way wey di situation dey worse dey disturb am.

Im dey call on di state goment make dem come help dem sharp sharp. Make dem establish police post and deploy military personnel to restore safety for di community.

Di Student Union Government (SUG) president say dem dey make efforts to improve security for di area but e be like say all dia efforts no dey work.

Im add say dem bin don beg di govnor and management for police checkpoint.

Im explain say dem dey try calm di students down sake of say dia body dey hot well well due to di rising agitation wey di kidnappings dey cause.

Source: BBC
Related Articles: