Menu

Alexx Ekubo family reveal wetin kpai di actor and wia e die

Actor Alexx Ekubo .png Family of Nigerian actor Alexx Ekubo don reveal say di actor die of metastatic kidney

Wed, 13 May 2026 Source: BBC

Family of Nigerian actor Alexx Ekubo don reveal say di actor die of metastatic kidney cancer.

Dem make di informate on di actor official Instagram handle wia dem officially announce im passing.

"Na wit profound sadness we announce di passing of our beloved Husband, Son, Brother, and Friend, Alexx Ikenna Ekubo-Okwaraeke

"After brief but courageous battle, Alexx pass away for Evercare Hospital due to complications wey arise from advanced metastatic kidney cancer," di family tok.

Di family say throughout dis difficult journey, Ekubo bear im pain wit remarkable strength, unwavering faith, and enduring hope, as e believe say one day im go share im testimony wit di world.

"During dis deeply painful time, we humbly ask for privacy and prayers for di peaceful repose of im soul, and for all wey dey mourn dis immense loss," di family tok.

Dem say further details about im funeral arrangements and oda family matters go dey communicated in due course.

"We sincerely tank evrione for di love, support, prayers, and understanding wey dey extended to di family throughout dis period."

Wetin be metastatic kidney cancer?

Wen cancer develop for di kidneys and spread to oda parts of di bodi, e dey known as metastatic kidney cancer – no mata wia di cancerous cells end up, according to Moffitt Cancer Center.

For instance, cancer wey spread from di kidneys to di lungs still dey considered to be kidney cancer and dem dey treat am accordingly.

Certain types of kidney cancer dey more prone to spread dan odas. High-grade kidney cancer dey involve abnormal cells wey dey more likely to invade surrounding healthy tissues dan low-grade kidney cancer cells. However, low-grade kidney cancer fit still spread. Dis na why prompt treatment always dey important.

How kidney cancer dey spread

As di tumour dey grow, e dey spread into fat or major blood vessels around di kidney. E fit also creep into di adrenal gland, wey dey sit right on top of di organ, according to WebMD.

From dia, e fit spread farther through your:

Blood. Cancer cells wey get into blood vessel fit travel to many bodi parts through your veins and arteries.

Lymph system. Dis na network wey dey run throughout your bodi, much like your blood vessels. E dey help you fight disease. But cancer cells wey get into lymph nodes fit enta oda organs.

Kidney cancer most often dey spread to di lungs and bones, but e fit also go to di brain, liver, ovaries, and testicles.

Symptoms of kidney cancer

Di symptoms of kidney cancer dey different for each pesin. For most cases, you go see blood for your wee-wee. You fit feel generally sick, tired, and like say you no wan chop plenti.

You fit also get:

Fever wey dey come and go

Lump for your belle

Night sweats wey go even make you change your clothes or bedsheets

Pain for your back or side wey no go go away

Weight loss for no reason

You fit also get symptoms for wia di cancer spread. If na for one of your bones, you fit feel pain for dia. If na for your lungs, e fit give you cough or trouble to breathe.

Treating metastatic kidney cancer

Wen treating metastatic kidney cancer, oncologists dey take several factors into consideration to determine weda surgery na potential treatment option, or if treatments wey target cells throughout di entire bodi go dey more appropriate.

Dem also also need to consider wia, specifically, di cancer don spread and di size of di primary tumour.

While certain treatments fit no dey recommended if di cancer don spread, more metastatic kidney cancer treatment options don dey available dan eva bifor.

For instance, drugs wey dey block di formation of new blood vessels (anti-angiogenic drugs) fit help slow down di process of metastasis.

Oda drugs fit block certain enzymes wey dey promote cancer growth. Dis and oda advances don help improve survival rates for patients wit metastatic kidney cancer.

Who be Alexx Ekubo

According to im bio ontop im official website, dem born Alexx Ekubo for April 10, 1986 for Port Harcourt, Rivers State Nigeria.

E bin train as lawyer for di University of Calabar, but na inside acting e really shine and later see fame.

Alexx win best supporting actor for di 2013 Best of Nollywood Awards ontop im role inside di feem Weekend Getaway.

For 2018, e gbab Special Recogition Award from di Nigerian First Lady say dem dey torchlight im contribution to di development of di Nigerian Entertainment Industry.

For 2020, Alexx bin dey inducted into di MIPAD/United Nations (Most Influential People of African Descent) Top 100 under 40 years hall of fame.

Alexx bin reveal anoda of im achievement as di governing council of the Institut Supérieur de Communication et de Gestion (ISCG UNIVERSITY) confer am wit Doctorate (Honorary) Degree in Arts & Culture for 2021.

E bin also collect di Nigerian National Award of Excellence wey im bin get for im charity work as di Global Social giving actor of di year.

Although im first major role as actor na Ladies Men.

As actor, Alexx get 116 credits for im feem role.

Di latest feem wey comot wit am comot for February dis year wey dem call Adanne.

Oda feems na Áfàméfùnà: An Nwa Boi Story, A Sunda Affair, Hire a Woman, Omo Ghetto - The Saga among odas.

Di 40 year old acor don collect nine awards wey im don collect ova di course of im career.

E bin collect di Black Entertainment Film, Fashion, Television, & Arts Award, London (BEFFTA) for Nollywood Rising Star and di Screen Nation Film & Tv Award (London) for Favorite Male African International Emerging Screen Talent for 2014.

For 2015, e collect di Nigerian Teen Choice Award for Outstanding TV Personality.

For 2016, e bag Best Actor of di year from Best of Nollywood and Model Actor of di year from di Nigerian Model Achievers Award.

For 2022, e win Best Lead actor for di Best of Nollywood and di Best Actor of di year from di Toronto International Nollywood Film Festival.

For 2024, e bin dey nominated for AMVCA for Best Supporting Actor for im role inside di feem, Áfàméfùnà.

Source: BBC