South Africa don release di list of ova 100 untraceable suppliers wey dey deceive customers
South Africa don release di list of ova 100 untraceable suppliers wey dey operate for di kontri by deceiving customers wey dey patronise dem.
National Consumer Commission (NCC) for South Africa recvently add 20 additional suppliers to di afta dem first release list of 93 untraceable suppliers wey some affected customers bin previously report.
According to di tok NCC tok tok pesin Phetho Ntaba, e say dem identify di suppliers through report and preliminary assessment.
"Di newly identified suppliers dey base in Gauteng, KwaZulu-Natal, and di Western Cape," di statement tok.
Di National Consumer Commission say make consumers dey careful wen dem dey deal wit dis suppliers as dem fit lose dia money.
Dem reveal say how di suppliers dey work be say dem go change address or close dia website afta dem don scam and receive payment from customers wey dey relate wit dem.
Di South Africa commission warn say 'make consumers exercise extra caution wen dealing wit dis suppliers, as dem fit lose dia hard-earned cash.'
Dem add say make prospective customers try to verify suppliers bifor dem make payments and to dey careful wen dem see some kain deals wey dey too good to be true.
Dis list of di untraceable suppliers released by South Africa NCC don increase go 110.
How dis untraceable suppliers dey operate
According to di commission, some of di suppliers dey operate online make am hard to sometimes trace dia address.
NCC tok tok pesin Ntaba say dia assessment show say di suppliers dey operate in a way wey be say dem go collect orders and payments, den refuse to deliver di goods or services wey dia customers don request for.
Dem say dis suppliers fit shutdown dia website or even change address witout telling dia customers.
"Some dey operate entirely online, making am even harder for consumers and authorities to track dem," di tok tok pesin tok.
Customers no fit trace dis suppliers wen dem run away wit money.
Dem release say dis suppliers dey work across different industry sectors like:
Auto parts, furniture, renewable energy,
.Car dealerships, auto insurance, marketing and advertising,
.Tobacco products, interior design, clothing,
.Construction and truck repair services.
"South African consumers dey effectively lose key protections under di Consumer Protection Act wen dem deal wit "untraceable suppliers," according to di National Consumer Commission (NCC).
According to di list, South Africa say dem go take am serious so dem fit protects dia citizens.
Di commission say make South Africans dey careful wen dey wan patronise any suppliers.
Also for consumers, dem say make dem stay wit di regulations wey di commission don give according to di Consumer Protection Act (CPA) - "make dem provide correct information, wit physical address and contact details.