Nigeria minister of information and culture, Lai Mohammed, say crimes of banditry and kidnapping no be federal offence but state offence.
Di minister tok dis one for statement as im sama response to di main opposition, di Peoples Democratic Party ansa on top accuse say goment of di ruling All Progressive Congress (APC) no dey do anytin to bring bandits and kidnappers to justice.
According to Oga Mohammed, terrorism na federal offence and as far as dis federal goment dey concern, e don successfully cari thousands of Boko Haram members go court for Kaiji.
Im say dem still dey prosecute terrorists and now wetin di federal goment need na di cooperation of di judiciary to continue wit di court cases of di ones wey dem don already arrest.
Inside statement wey in release for press conference, di minister say: "E dey shocking say party wey don rule dis kontri for 16 years no sabi say kidnapping and banditry no be federal offence."
E add say if the opposition part dey find who to blame, make dem blame state govnors including di ones for states wey dem dey control to make sure dem seriously arrest and cari di kidnappers and bandits go court.
- Police clash with 'ghetto youth' at Dambai, teenager killed by stray bullet
- Man burns himself to death after attempting to strangle wife at Abeka
- Court convicts student for issuing dud cheque
- Self-styled businessman on GH¢350,000.00 bail over alleged car fraud
- Watch as suspected robbery syndicate member is busted two weeks after being caught on CCTV
- Read all related articles